Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Wednesday, 5 October 2016
AFTER HE THROW HIM EXPENSIVE NECKLACE ENTA CROWD FOR SHOW TO MAKE HIN FANS HAPPY,SOUTH AFRICA RAPPA, AKA,DON BEG ANYBODi WEY SEE Di CHAIN MAKE HE GIVAM BACK
E be say di igbo wet South Africa rappa,Aka smoke bifor him enta stage don clear for him eye.
Wetin pesin go yarn for did kain mata.
Afta he throw him rapper dog chain enta crowd, di bobo don dey beg pesin wet di tin touch hin hand to bringam back say di tin dey too expensiv.
He say di Soweto ganja wet him smoke don clear for him eye so diafor,him reading to buy di chain back from di pesin hand.
I wisham goodluck for di search.
E nor go izi.
AFTER HE THROW HIM EXPENSIVE NECKLACE ENTA CROWD FOR SHOW TO MAKE HIN FANS HAPPY,SOUTH AFRICA RAPPA, AKA,DON DEY BEG ANYBODi WEY SEE Di CHAIN MAKE HE GIVAM BACK BICOS E DEY EXPENSIVE
E be say di igbo wet South Africa rappa,Aka smoke bifor him enta stage don clear for him eye.
Wetin pesin go yarn for did kain mata.
Afta he throw him rapper dog chain enta crowd, di bobo don dey beg pesin wet di tin touch hin hand to bringam back say di tin dey too expensiv.
He say di Soweto ganja wet him smoke don clear for him eye so diafor,him reading to buy di chain back from di pesin hand.
I wisham goodluck for di search.
E nor go izi.
Tuesday, 4 October 2016
Di KING OF AKPOLA SHOE AND WOMAN DRESSING,DERENLE,DON YARN SAY,ANYBODi WEY NOR LIKE HIM DRESSING,MAKE HE CARRY AM GO COURT
If you dey folow up and u neva still know di kain life wey di akpola King,Derenle dey live,naim be say,u are on a long tin.
Di bobo nod babe skirt and babe top to di 2016 Aquafina elite model look,on sunday nite and bifor u go start to konplain di bobo don alreadi tell di world say,anybodi wey no gbadun hin dressing,make dem carry go court.
Dat one go be wasting of time.
Court don alreadi rekognaiz Derenle madness.
SEE Di PICTURES WEY MAKE ONE BABE SAY, 'SHE GO RAPE RMD'
Oloshos don carry dia trade to anoda level as one of dem don readi to break RMD bed.
Richard Mofe Damijo (RMD),jejeli post some pikchors on top Instagram base on wetin Instagram be.
Bifor he go talk say, 'Aladja' is a noun,one babe don korment for hin pikchor say, she go rape RMD and enta jail.
Rmd,watch yor back,oloshos don carry your mata for head like lakpalakpa.
Monday, 3 October 2016
MR IBU SAY LAGOS STATE TEACHING HOSPITA STAFFS NAIM KILL HIN PIKIN BICOS DEM NO GET FUEL FOR GEN AND WEN HE GIDEM MONEY FOR FUEL,DEM SAY Di GENERATOR OPERATOR DON COMOT
Mr Ibu lost hin two years old son for 2012 and he blame Lagos state teaching hospita,LUTH,dat time for di pikin death.
He don come out talk wetin rili appun as he say,afta NEPA seize light as usual,he expect di hospita to use dia generator.
But him shock wen dem telam say,dem nor get fuel.
Mr Ibu look up,look down and stil gidem money to buy fuel only for dem to telam say,di generator operator don comot.
Play play,play play,na so dem waste all di time wey dem for take save di pikin,until di boy kon die.
Nollywood star Ibu say,wetin pain am pass,na afta di pikin die,one doctor stil get mind waka kon mitam say,make he giv dem di dead bodi so dat dem go use am take do pratika for students.
Na wa o!
Pipo get mind o.
Dat doctor sha.
Sunday, 2 October 2016
NAIJA COMEDIAN,GANDOKI,DON BREAK GUINESS BOOK OF RECORDS FOR Di LONGEST TIME OF PESIN WEY DEY CRACK JOKES..AND Di TIME NA, 42 HOURS 10 MINUTES
For 42 hours 10 minutes naim Gandoki take crack jokes and dis one givam di title of di Comedian wey don yarn jokes for di longest piriod pass.
Na 48 hours him bin dey fight to rish but e be like say,hunger won finish di bobo nor be bicos of lack of jokes.
But di 42 hours 10 minutes wia he for stop,dey enof to break di Guiness book of records for comedians.
Dis one don make Gandoki di first naija comedian wey go enta dis Guiness book as we stil dey wait make dem confamam.
Congratulabia in advance.
Warri nor dey carry last.
Saturday, 1 October 2016
HALLELUYAH! CRISTIANO RONALDO DON ESCAPE DEATH AS HIN PRIVATE JET DON CRASH BUT Di BOBO GET LUCK BICOS HE NOR DEY INSIDE Di PLANE WEN Di ACCIDENT HAPPEN
![]() |
| Di LANDING GEAR |
Di luck about di mata be say Ronaldo nor dey inside di plane as he dey Dortmund dey prepia for dia match wen di plane get fault on Monday.
Di plane landing gear,brake and e skata and as dem land.
Di emagensi pipo wey dey on ground,rush go hep di pilot bifor water pass garri.
Dem later treat di pilot for minor injuries.
Cr7 put di private jet on hire for konpinis and na one of di konpini dey use am wen he take crash.
Ronaldo buy di jet for £15 million last year.
Subscribe to:
Posts (Atom)


