MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday, 6 February 2017

Di RUGGED GOFNOR OF EKITI STATE,AYO FAYOSE,DON TELL TORi PIPO SAY,HIM GO BE PRESIDENT OF NIGERIA ONE DAY BUT MAKE ANYBODi NO ASKam HOW E GO TAKE HAPPEN


Buhari nomba one enimi,Ayo Fayose of Ekiti state and PDP,don yarn say one day,him go be Naija president.
He say God don sign am say him go enta Aso Rock one day not as visitor but as president.
Akordin to di rugged Gofnor,he say him nor know how e go take appun but e go appun.
Afta he rule di first four years as Ekiti Gofnor,him talk say him go come back and true true he don come back and now he don yarn dis one again.
Ok o,we dey wait.
Pastor Chris Okotie don yarn dis kain tin bifor of how God take telam say him go bikom Nigeria president.
Till today,na only di president of him church for Ikeja naim he be.

Saturday, 4 February 2017

BREAKING NEWS!!!! 2FACE DON CANCEL Di FEBRUARY 6th PROTEST AGAINST BUHARI GOFMENT


Nigerians wey rili want make di February 6 protest against Buhari gofment take place,go wake up to hear say,tubaba don run enta hin comfort zone back afta all di noise.
Akordin to Tubaba for di vidio wey him reliz,he say nobodi life worth to put on line for dis protest.
Wetin we neva know now be say,weda dem put gun for 2face head wey make am change mouth.
We go bring una more tori konsigning dis mata as we getam.

FORMA PRESIDO OBASANJO,DON YARN SAY,NA 12 TIMES BAD BELLE PIPO CARRY RUMOR SAY HIM DON DIE AND ANYBODi WEY DEY WISH BUHARI DEATH NA WICKED PESIN


Obasanjo a.k.a Obj,don yarn tori pipo say na about 12 times bad belle pipo carry rumor say him don kpeme so nor be new tin.
He yarn dis one just bicos some pipo dey carry rumor say Buhari don kpai.
Akordin to OBJ,he say instead of dat kain wish,e beta make pipo dey pray for Buhari bodi to dey kamkpe so dat he go fit come back strong and rule well.
Obj also yarn say na wicked pipo go dey wish anoda man death.
If u rememba,since Buhari go London two weeks ago for holiday,rumors enta town say di man don kpai for yonda.
We nor know wetin to biliv again as some say he dey alive and Dem Siam dey play table tennis wit Queen Elizabeth for London last week.

Friday, 3 February 2017

NO MORE ARGUEMENT AS AMERICA COMPOSERS ASOCIATION DON GIVE WIZKID OGBONGE AWARD AS Di PESIN WEY WRITE 'ONE DANCE' FOR DRAKE,Di BIGGEST SONG FOR Di WORLD LAST YEAR




Wen Seyi Shay tell Onstage TV for Jamaica one sikrit say,na Wizkid write 'One dance' by Drake,di biggest song for di world last year,na Wizkid first tell her to shut up and stop to talk wetin she nor know.
But today,di same Wizkid don thank Drake wey allow ram write and be part of di song afta he kolet award on top di song head.
Wizkid post di award wey America Society of Composers,Authors and Publishers(ASCAP) givam for writing di song wey skata evriwia last year.
If na me be Wizkid,i go call Seyi Shay and tell her make she nor vex base on say he nor want make di world know di sikrit yet.
Anyway,Ogakpatakpata dey kongratulate Oga Starboy Wizkid,on top dis ogbonge award wey America pipo carry givam.
More fire!

Thursday, 2 February 2017

YEMI OSINBAJO,ASO ROCK NOMBA ONE MAN FOR NOW UNTIL BUHARI RETURN FROM HOLIDAY,DON SET UP COMITEE TO REDUCE Di PRICE OF GARRI,TOMATOES,FISH AND OTHER FOOD STUFF


Di way wey food stuff take cost for market now,don finally start to dey giv our lidas white hair join di one wey dem get bifor.
Acting presido,Yemi Osinbajo don form one komiti to find how dem go take reduce di price of food stuff wey dey inkriz evriday like say dem swear for naija.
Among pipo wey dey dis 7 man komiti na,Audu Ogbeh,Chris Ngige and Rotimi Ameachi.
Make we dey watch weda dis one go work bicos I know say gofment sabi promise and fail welwell.

Wednesday, 1 February 2017

POGBA AND LINGARD OF MANCHESTER UNITED DEY BUBBLE TO WIZKID NEW SONG (VIDEO)


World most expensiv footballa Paul Pogba and hin Manchester United team mate Jesse Lingard enta bubble mood for Man U dressing room as dem dey bubble to Naija supastar Wizkid new song Hush up the Silence(Come Closer).
Meanwhy,Sony Music wey get Wizkid miuzika propatis for now,don remove di song online as dem say dem neva reliz di song yet.
Dem say di one wey pipo don get na likage and illegal.
But wait o,so Man U,abi na Pogba and Lingard rush download di song?
Naim be say dem nor buy am.
Anyway na Wizkid be di winna for di mata as di bobo don blow enta evriwia.
Watch for botom hia,wetin dem use di song do for dia dressing room...


BURNA BOY DON YARN SAY HE NOR TOO LIKE SCHOOL WEN HE DEY GROW UP BUT HE DON ADVICE ANYBODi WEY WON TAKE MUSIC AS HIM CAREER TO GO SCHOOL AND GET DEGREE FIRST


Like to party singa Burna Boy don advise boys and girls wey won take miuzik as dia karia,make dem go school and get degree first bifor dem tink miuzik.
Di bobo yarn dis one on top Instagram as he also yarn say,him nor too like school wen he dey grow but he nor want make u follow him footsteps.
Good advice from di River state born bobo.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...