MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday, 11 February 2017

Di ABANDON MUDA LAWAL STADIUM FOR ASERO ABEOKUTA,OGUN STATE WEY DEM NAME AFTA Di LATE SUPER EAGLES LEGEND WEY DIE 25 YEARS AGO,DON TURN TO TRAILERS PARK

Wen Naija gofment sef go get sense?
Abandon project evriwia for dis kontri.
Imagine na trailers Dem dey park now for di Muda Lawal Stadium for Asero,Abeokuta,Ogun state.
Dem name dat Stadium afta di late Green Eagles wonda player wey die for July,1991.
Di Ogun state gofment nor fit just use dia church mind konplit dis Stadium for dis national hero sake.
No wonda many pipo nor won die for Nigeria mata again.
If na lie,ask Sam Okwaraji famili.

Friday, 10 February 2017

GOD IS GOOD: ONE GOOD SAMARITAN DON PROMISE TO RENT HOUSE AND OPEN BIZNESS FOR Di CRIPPLE WEY SOLDIERS NEARLY BEAT DIE FOR ONITSHA


Dem don arrest di two soldiers wey niali beat dat cripple die for Onitsha sake of say dem siam wear di kolor of dia khaki.
Akordin to Nigeria army,dem say dem go show di two sojas shege.
I still biliv say dat na stori until dem show us dia face and do open trial for dem make di whole world see.
But di good news wey rish our tori room be say,one Good Samaritan Mr Kokun of Kokun Foundation  don promise to rent house and open bizness for di cripple.
God nor dey sleep.
Nice one Mr Kokun,God bless you.

Warning!

In case you neva watch di video wey sojas for dey beat di cripple,watch am for bottom hia...but Rememba say, Dis video nor good to watch for eye sha


Thursday, 9 February 2017

ACTRESS YVONNE JEGEDE,DON BEG NAIJA PIPO MAKE DEM KONTiNiU TO BUY RECHARGE CARDS FROM PIPO WEY DEY HAWK INSTEAD OF FROM BANKS SO DAT HUNGER NOR GO KILL HAWKERS


Nawadays,u can wake up for 2 O'clock midnite and buy recharge card from your phone tru ya bank account.
You nor need to wait make daybreak and go buy for shop if u get impotant call wey u wan make.
But Nollywood actress,Yvonne Jegede,don beg Naija pipo make dem nor stop but kontiniu to dey buy recharge cards from hawkers hand and pipo wey dey sell for shops instead of to dey buy online or from banks.
Akordin to Yvonne,she say hungri go beat dis hawkers if banks drive dem from bizness so diafor,make we kontiniu to helep dia bizness grow.
E nor go easy sha.
Wot if u get impotant call teakettle for mid nite and u need recharge card?

GOD FORBID! NAIJA SOLDIERS NEED EDUCATION AS DEM NEARLY BEAT CRIPPLE DIE FOR ONITSHA

If you carry 10 billion dollars gimme make I do wetin Nigeria sojas do dis cripple for dis video,I go still reject di money.
Dem beat di cripple niali die for Onitsha sake of say dem siam wear dia colour of dress.
Bifor dem start to beat am,dem first troway him wheelchair.
Wen I dey hear about devil devil,I feel say na joke but dis sojas make me biliv say tru tru devil get followers.
If Dem see Boko Haram dem go run but wen dem see innocent sivilians,dia dada go stand.
Dis video nor good to look for eye but if u won watch am,look am for bottom hia...


SEE FINISHING! DEAD OR ALIVE,NIGERIANS SUFFER NA STILL Di SAME UNDA BUHARI AKORDIN TO 'FINANCIAL TIMES' DAVID PILLING


London newspaper 'Financial Times' writer,David Pilling,don write say,weda Buhari dey alive or not,e nor change anytin for how Naija mata dey go.
He say for 20 months wey di forma General dey rule Nigeria,diferens nor dey bitwin enjoyment and suffer.
Well,we dey wait to hear from our gofment officials like Femi Adesina and Lai Mohammed to ansa David Pilling of Financial Times.
My hand nor dey.

Wednesday, 8 February 2017

GORDONS DON YAB 2FACE AS Di ONLY MUSICIAN WEY NOR GO SCHOOL BUT SABi SING AND NA DAT SINGING HE SUPPOSE TO TAKE FIGHT BUHARI INSTEAD OF TO DEY FORM VOLTRON




Afta 2face high pipo spirit say him go lead protest against Buhari gofment on February 6,sake of say hungry don too much for di land,di bobo kon cancel Di protest for last minute.
Since den,many pipo don dey call am names.
Some say him na coward,some say him na Mumu,some say him na paper tiger,some say him na woman,some even say naim be di real Africa queen.
Now Komedian Gordons,don giv 2face yabbing of di year as he call 2face di only illiterate wey sabi sing correct miuzik and na dat miuzik he sopose use take fight Buhari instead of am to dey form actor.
Since Gordons call 2baba illiterate,nor be small insult him don resiv from 2face hand.
Watch Gordons for di vidio wia him for blast 2face for bottom hia...


Tuesday, 7 February 2017

DANFO DRIVERS MAKE UNA START TO PLAN UNA LIFE AGAIN BICOS LAGOS STATE GOVNOR AMBODE,DON TALK SAY,HIMGO REMOVE ALL Di YELLOW DANFO BUS FROM LAGOS ROADS DIS YEAR




I no go soprise if I see miuzishans Mad Melon and Mountain Black a.k.a Danfo Drivers,lead protest of 'we nor go gree' against Gofnor Akinwunmi Ambode plan to ban danfo bus from Lagos.
If u still dey Read dis tori wit sleep eye,try wash yor face bicos Ambode don yarn tori pipo for one joinbodi meeting yestaday say,him go remove all those yellow danfo buses from Lagos roads and replace dem wit beta transport buses.
My only advice to my frend Ambode be say,make he plan dis mata well bifor he ban danfo drivers hustle.
I nor won hia say,arm-robas start to give pipo yawa for Lagos.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...