MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday, 30 July 2014

GOVERNOR ROCHAS OKOROCHA DEY RIDE BICYCLE WITH POLICE ESCORT

GOVANOR ROCHAS IS RIDING A KEKE
Exercise good welwel for bodi.
E go make yor bodi strong kakaraka,e go make u no dey sick anyhow,e dey build yor muscles,e dey build yor brain,e fit make orobo turn lekpa,e dey make yor brain dey sharp welwel,e dey reduce stress,exercise dey drive sickness and do plenti oda tings for our bodi.
To dey ride keke na gud way to take do exercise,even kpakpa sef u fit use am make money bicos pipo like di Americana,Lance Armstrong,use keke-riding take make millions of dollars. 
Sake of bodi to dey gidigba naim make di Govanor of Imo state,Rochas Okorocha carry keke enta road go practice and do exercise in oda to keep fit and less im big belle.
Na for inside twitter naim Rochas put di pishor of how im dey exercise wit keke bicycle but one tin wey soprise pipo be say police escot van dey followam for yansh as e dey ride di keke.
Rochas yarn for twitter say "my pipo,my pipo,I dey kip mysef strong kakaraka,hope say una dey do exercise make una bodi dey kamkpe too?"
E be like say no be onli exercise Govnor Rochas dey do,I sure say im also dey practice to run for next year tour de france di nomba one keke race wey dey shele for France and maybe to sell ice cream wit keke wen him tenior don end as di Imo state ogakpatakpata nomba one.


Sunday, 27 July 2014

BLESSING OKAGBARE DON GET BLESSINGS FROM USAIN BOLT PAPA AND MAMA TO SHINE FOR COMMONWEALTH GAMES.

OKAGBARE POSE WITH USAIN BOLT POPSIE AND MOMSIE

Wot eva love and blessings wey di world record holder for both 100metres and 200metres Usain Bolt get from im paale and maale wey make am dey tear race like okada,Naija runner Blessing Okagbare feel say she don resiv dat kain blessings from dem as she take pishor with di old boy and old geh wey bring Usain Bolt come dis world.
Okagbare meet Usain Bolt pileh and mileh for Scotland wia dis year commonwealth games for dey shele.
She put di pishor for her facebook page and she tok say she dey veri veri happy say di popsie and momsie of a big name, a legend,Baale of athletics Usain Bolt take notice of am.she say she dey veri proud and dis one na blessing to ram.
Naija put hope for Okagbare shoda welwel as na one pesin wey we biliv say he go make us proud espeshally as di main babe wey dey giv her headache Shelly-Ann Fraser Pryce no attend dis games.
BLESSING OKAGBARE
Okagbare go represent Nigeria for 100metre,200metre,long jump and relay for Glasgow,Scotland and she go try to follow di footstep of Mary Onyali for Victoria,Canada,1994 wey win 100 metre Gold,silver for 200metre and Gold for 4X100metres relay gold wit new commonwealth record of 42.99seconds.
If una rememba for Friday Novemba 9,2007,na Abuja naim Glasgow difit to host dis games.
Na 71 commonwealth memba kontris  vote for di join bodi wey dem do to announce di winna for Sri lanka.
47 kontris vote for Glasgow,Scotland why 24 kontris vote for Naija.
Di commonwealth games na for kontris wey England colonise and na evri 4 years e dey hapun.
Dis year games stat for July 23 and go end for 3rd August,2014.

SOUTH AFRICA DON CHOOSE SON OF THE SOIL EPHRAIM MASHABA AS DIA NEW COACH



 

KESHI


 Dem say di devil u know is beta dan di angel u don't know as South Africa futbol assosiashun,SAFA, yestaday don choose di angel wey dem know Ephraim Mashaba and scata di hope of Stephen keshi to coach di bafana bafana.
Keshi as many tori pipo don report for di past 3 months dey eye di hot seat for Sauti as e imsef don even yarn say e dey posible say e fit leave di super eagles job and go work for South Africa.
But yestaday,SAFA choose Mashaba wey e guy name na "Shakes".
Mashaba don coach Bafana bafana 3 diferen times b4 and naim be di present coach of dia Under 20 nashona team wey dey Mali presently for training wit di team.
No be onli Keshi South Africa bin dey eye for di post bifor as forma Manchester united assistant to Alex Ferguson and di present Iran coach,Carlos Queroz naim get di brightest chance pass for di job but di salary wey him want big pass wetin SAFA get to pay.
Di gud news for Keshi be say,although him kontrat don finish wit Super eagles afta di world cup for brazil,but NFA executive comiti don announce for di small join bodi meeting on Monday for Abuja wey dem take impich and sack dia chairman,Aminu Maigari,say dem go soon stat to negoshate wit Keshi to renew im kontract.

Wednesday, 23 July 2014

SORRY ARSENAL FANS,LIONEL MESSI NEARLY PLAY FOR ARSENE WENGER LAST SEASON.



If you like call Arsenal 'Top 4 team' but di tin be say 4 time world futbola of di year and di best playa for Brazil 2014 world cup akordin to FIFA,Lionel Messi don tok say,Barcelona get luck,im for sign for arsenal last year.
He say like say Barca kontiniu dat dia shakara not to inkriz im salary,notin for make am no sign for Arsenal futbol club akordin to VOZPOPULI one ogbonge website wey dey for inside Spain.
Yes o!akordin to VOZPOPULI,Messi beg forma Arsenal captain,Cesc Fabregas make he yarn him agent,Darren Dein to arrange him waka to Arsenal but e be like say Barcelona hia di rumor naim dem quik quik giv Messi di salary wey di soca magician ask for.
Arsenal bank account for hear nwhi bicos di money wey Barcelona put for Messi head na 197 million pounds if u won buy am and na smol tin all di moni wey Arsenal don spend for dia history take pass dat moni.
But as di mata be now sha,di small engine big motto for world futbol,Lionel Messi dey on a salary of 16 million pounds a year kontract for Barcelona.

Thursday, 17 July 2014

OJUJU CALABAR DON CAUSE DI DEATH OF ONE 5 MONTHS OLD PIKIN.


 
 No be small tin o,as one masquarade don cause di death of one pikin for  Amakohia Ubi, Owerri West Local Government Area of Imo State.

As di masqurade dey pursue one 10 years old geh wey carry di pikin,she kon run enta backyard but eye of fear,naim di geh trow di 5 monts old pikin for inside 'mama put' pot of soup.
Akordin to Chika,one woman wey see evrytin as e take hapun,she say as di ojuju man see say di pikin don draw for di geh hand enta put of soup,naim e take yawa race.even di geh wey carry di pikin,fall yakata for near fire and na smol tin remain fire for roast her like corn and ube.
Although sha,di villagers try to reskiu di pikin but as dem rusham rich hospito,dokita kon tell dem say di baby don already kpeme.

Sunday, 13 July 2014

MESSI NEVA PLAY ANY BETA BALL FOR DIS WORLD CUP-GARY LINEKER OF ENGLAND

LIONEL MESSI




One of di stars of Italia '90 world cup,Gary Lineker of England don yan say 4 times world futballar of di year,Lionel Messi of Argentina neva play any beta futbol for dis world cup wey go end for Brazil today.
He say tho Messi and Argentina don qualify to play Germany for today final but di bobo neva impress at all apart from di bigining of di world cup wen dem play Bosnia,Iran and Naija.
Lineker say im na Messi nomba one fan and e neva see pesin wey get swit talent richam since afta Maradona.
Gary say he chop plenti colanut make sleep no katcham and e shine im eye welwel watch Messi for dia semi final match against Holland and di only time wey Messi leg toch ball for di goalkipa area na wen e play penarity.Lineker say no be di Messi wey him know be dat.
He say tho Messi don skor 4 goals wen di world cup fest stat but all di smol beta tins wey Argentina play for di match against Holland,Messi no dey involve for any one.
He say anyway sha,if Messi win di world cup e go hepam for di argument of who beta pass bitwin Messi and Maradona.
GARY LINEKER

Gary Lineker also tok say na Maradona be di best playa wey im don play against wen im stil dey tap leather.Lineker say as Maradona shot rich,di kain chocolate futbol wey di guy play no be here .




Saturday, 12 July 2014

CRISTIANO RONALDO BEAT LIONEL MESSI

CR7
Messi fit don qualify to play for di final of dis year world cup for Brazil but Messi moni dey learn for wia di kain moni wey Ronaldo resiv last year for all mata like adverts,salary and all oda gbogboyen.
Akordin to Forbe richest list of sports pipo,one ogbonge magazine wey di hole world dey respet,na only one bobo naim im moni long pass Ronaldo own and dat bobo name na Floyd May Weather Junior.
May Weather na one wicked boxer wey no dey use eye see im felow boxer for inside boxing ring.im blow plenti boxers face swell up and blood even dey rush for some nose and dia eyes.di true tori be say nobodi don defeatam once since e stat to fight. 



FLOYD MAYWEATHER


If u won know di list of di richest sports bobo for di hole of 2013,checkam for bottom hi

  RankNamePay
  #1Floyd Mayweather$105 M
  #2Cristiano Ronaldo$80 M
  #3LeBron James$72.3 M
  #4Lionel Messi$64.7 M
  #5Kobe Bryant$61.5 M
  #6Tiger Woods$61.2 M
  #7Roger Federer$56.2 M
  #8Phil Mickelson$53.2 M
  #9Rafael Nadal$44.5 M
  #10Matt Ryan$43.8 M.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...