MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday, 28 December 2014

RECORD BREAKER:GARETH BARRY THE FIRST PREMIER LEAGUE PLAYER TO COLLECT 100 YELLOW CARDS


Gareth Barry don bicom di first player in history since di English Premier League start for 1992 to collect 100 yellow card for field.
Di Everton midfielder bin dey 99 bifor referee kon givam one more for boxing day wen dem play against Osaze club, Stoke City.
Some pipo dey break record for di right reasons why some dey hold record for di wrong reason.
Dis na one yeye record wey Gareth Barry go dey pray make anoda player quick beat so dat im mind go comot for dis bad boy for class record.
No be only im dey dis club of plenti yellow card collectors as I go give you di top ten.
Check bottom hia to know players wey make di top 10:

1.Gareth Barry     100 yellow cards
2.Kevin Davies      99          "
3.Lee Bowyer        99          "
4.Paul Scholes       97          "
5.Scott Parker         92        "
6.Robbie Savage    89         "
7.George Boateng  85         "
8.Kevin Nolan        83         "
9.Wayne Rooney   83         "
Phil Neville             82         "



Saturday, 27 December 2014

PIRATE THINGS: GOVERNOR LIYEL IMOKE DON TURN P SQUARE TO NINJA MEN AS Di 2014 CALABAR FESTIVAL DON BEGIN




Di biggest street party for Africa, di Calabar Festival,don dey witness di highest numba of mushimushi dressing again as di biggest ejime for town, P square don join di 2014 Calabar craze.
Fine fine funny dressing in di spirit of carnival naim dey always dey appun for dis biutiful city as many celebrities always dey gada to celebrate di ''show yorsef dressing and jolliment gbedu''.
JIM IYKE DEY TROWAY SALUTE

Di Cross River govnor, Liyel Imoke and di first lady, Mrs Obioma Imoke, Kate Henshaw,alongside di new Ninjas in town, P square,na dem lead di join bodi for di 2014 Calabar fashion parade.Mrs Imoke naim declare di carnival open yestaday wit di children carnival.
See some biuriful pictures for yorsef;









Friday, 26 December 2014

CHRISTMAS EVE MIRACLE FOR PEOPLE AS N850M DON TROWAY FOR BUSY HONG KONG HIGHWAY

Christmas groove start early for many pipo for Honk Kong as dem pack plenti money wey spill for road like oil spillage wey appun for Niger Delta.
British security firm, G4S, wey dey responsible to transport about $4.5 million for Hong Kong,don enta heavy igbese (debt) as dia securiti van driver, no know say di back door no lock well and dis one kon make almost all di money troway for one busy highway for Wan Chai.
No be small drama as passers-by,taxi drivers, okada riders, mama, papa, pikin,mama akara and all sort of pipo rush enta road and pack di one wey dia power reach.
All di money wey leak from di bullion van, dey in Hong Kong 500 dollars note.
Out of di $4.5 million,( 850 million for naira),police announce say na $2 million dollars still dey miss and dem don dey beg pipo to return dem or else na 10 years criminal offence dem dey commit so.
Bicos of di faulty back door wey make di money locate di packers see, no be small traffic di drama cause for Wan Chai area for Hong Kong.
We for hia go put ear for ground to know weda Hong Kongers go return di one wey dem pinch from di chrismas watchnight miracle.

Tuesday, 23 December 2014

30 MILLION TO ACT BLUE FILM TOO SMALL-MAHEEDA


If your bizness na to recruit pipo wey dey act blue film and yor budget no pass 30million naira, make you no near were Maheeda dey bicos she fit spit for yor left eye.
Di goddess of X as dem dey call her nowadays,yarn for twitter say, dem give her 30Milla job to act blue film and show her bedmatics skills.
Maheeda yarn say,"Can u imagine dis kain insult?"dem won pay dat kain small money for me to do sirios further maths for bed! Dat one na money?idiot!  Two of my cars money naim be dat na!
Maheeda para welwell for twitter and she kon stil yarn say,"To do blue film na beans?if yor money no go change my generation future, park well oohhhh..I no go do any blue film! Oshofree dem".

Monday, 22 December 2014

DI WORLD BIGGEST CROCODILE DON SHOW FACE FOR PANAMA


Like say di popular late crocodile hunter from Australia, Mr Steve Irwin, still dey alive, trust am, he for don catch di nearest flight go Panama go play wit dis giant crocodile wey pipo don alreadi dey call di biggest crocodile ever.
Bifor dis one show face for dis kontri wey dem dey call Panama, di biggelest crocodile for di world dey measure 18 feet long and e dey weigh 2,200 pounds.
Na chicken,fish and pork meat di owner take dey feedam.
Dem even name am Cassius and na 111 years we hear say di crocodile live.
Wit dis new crocodile wey dem catch for Panama canal so, e be like say Cassius tenure as di largest crocodile don expire.
As I dey write dis tori, dem say di pipo wey catcham for di canal don rush go buy tape for market to measure ram.
I go bring una di figures of di measurement wen dem measure ram finish.
Di owner, George Craig dey feed Cassius wit pork meat.

PATIENCE OZOKWOR COOKING AND FRYING TINS FOR IBINABO FIBRESIMA WEDDING

Nollywood shekens,Empress Njamah naim nack dis pictures of her and star actress Patience Ozokwor AkA Mama G for Internet of wen dem dey arrange di wakis wey pipo go blast for Actors Guild of Nigeria Presido,Ibinabo Fibresima wedding.
For those of una wey feel say dem go hire caterers for di mata, una sorry o bicos dis na pure African woman charcoal cooking no be sherekabia.
No time for time wasting.
See more photo for bottom hia:

GOVERNOR JONAH JANG DON APPOINT HIM PIKIN AS COMMISIONER FOR PLATEAU STATE

πŸ’ƒπŸ’ƒπŸ’ƒπŸŽΌπŸŽ΅πŸŽΆπŸŽ€πŸŽ§
Join me as i dey sing Mr lover man, Shabba song if u still rememberam as u dey read dis tori.
As I see dis tori on Govanor Jonah Jang, di first music wey enta my head na Shabba Ranks music,'Family Affair' wen im sing some years ago.
Di Govnor of Plateau state Mr Jonah Jang,don show say di family come first for im brain as he don appoint im son, Yakubu,as commisioner for Land and urban planning.
Yakubu Jang nor new to government as bifor dis new appointment, naim be Special adviser for Special duties to im papa.
Akordin to di commissiona for information for plateau, Mr Mohammed Abubakar, Yakubu Jang go replace Yilji Gomwalk.
Gomwalk naim dem pick as di running mate to PDP govnorship aspirant,Mr Gyang Pwajok For di 2015 elections.
Make I siddon dey watch wich politician go appoint im family pesin next for anoda position.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...