MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday, 7 February 2015

2FACE SAY MAKE GOVERNMENT INTRODUCE PIDGIN ENGLISH ENTER SCHOOLS

2baba don yarn say make govment use dia church mind and introduce pidgin langua enta naija skuls espeshally all dose skuls dem for villa.He yarn say all dose smallie for villa na pidgin english be most of dem second language,so for dat rizin,e good make govment introduce am to develop dia yarnings and to use am transfer knowledge to dem since dem undastand di language like a,b,c.
2face yarn all dis one on top dia join bodi talk for MTV Base wey dem dey call #Choose Or Lose Round table wey go start dis friday.
2face yarn say,dem fit employ some pidgin professors like you and me,pipo wey sabi di pidgin english langua reach ground.
He say dis na di only way wey dem fit take reduce di gap bitwin pipo wey dey use big big grammar and pipo wey dey soak pidgin language.




Wednesday, 4 February 2015

OSINBAJO DON PLEDGE TO GOD NOT TO THIEF PUBLIC SERVANTS MONEY


Di man wey go bicom di second in command for naija just incase General Muhammadu Buhari win next weekend presidential election,Profesor Yemi Osinbajo don say,if you no go believe am for  anytin at all make u believe am for only one tin.
He say if he bicom di vice president,he can neva touch government money.
He say if dem like make dem givam Central Bank key,im no go touch govment kobo lailai.
He yarn all dis one yestaday on top twitter.
He say him don enta agreement wit Baba God say im no go tiff govment money bifor and afta.
Many pipo go say na lie lawyas take dey chop why many pipo go won biliv all dis kain talk if na pastor talk am.
Profesor Yemi Osinbajo na lawya and sinior pastor at di same time for Redeem christian church of God,RCCG.
You biliv say dis man no go touch gofment money if im oga,Buhari win Goodluck Jonathan for di election of who go bicom Nigeria presido for 2015?

ABOMINATION! ROBBERS DON ROB 60 YEARS OLD WOMAN OF PLACENTA


Two robbers run out of ideas yestaday for Agboju area of Lagos as dem snatch bag from 60 years old mama hand.
Di placenta of di baby boy wey her daughta just deliver for hospital dey inside di bag.
Money and some oda tins also dey inside di bag.
Di woman wey her name na Mrs Onwumere bin dey go troway di placenta but she kon stop for Agboju market to buy ingridients to take prepia pepper soup for her daughta base on say she just born.
All dis drama appun around 9 PM and mama sef dey veri sad for wetin di robbers do toram.
Na pipo wey dey around dat nite na dem kon gada money give di woman wey she take finally buy di pepper soup tins.

Tuesday, 27 January 2015

CHAI! SEE GOVERNOR ROCHAS OKOROCHA DEY DANCE SHOKI

Dem say pipo  wey get sweet mouth pass for di world na politicians.is either dem dey tell u sweet sweet tins to buss yor brain so dat u go vote for dem or dem go use doings hold you for local just to get your vote.
If u see di kain shoki wey Govnor Rochas Okorocha of Imo state dance on Tuesday for APC campaign rally, u go fear.
You go even begin ask yorsef queshon say,"ehen, so dis big men know about galala and shoki too?
Yes! Di tin be say dem even know about di kontri problems more dan u but dem dey act blind from morning til nait.
Dem know say NEPA dey one corner dey craze dia own, dem know say mosquito dey follow us drag who get nigeria bicos of no beta drainage, dem know say pot holes don draw maps of africa full our road, dem know say naira dey fall yakata against di dollar anyhow, dem know say our mama dey suffer to buy kerosine bicos e scarce and e cost,den know plenti tins.
May God hep us.

Wednesday, 14 January 2015

PRESIDENT GOODLUCK JONATHAN DON SIGN ORITSEFEMI


Mercies of di Lord neva still stop to dey come down on di Delta born bobo, Oritsefemi as President Jona don vex sign am as di official musician wey go dey follow am go anywhere wey him dey carry campaign enter.
During di president campaign for tafawa balewa square for Lagos for next month election, Oritsefemi scata evriwia wit im performance as even oga Jona stand up and join evribodi dey sing along to double wahala, di music wey don catapult Oritsefemi name enta evri area and evri kona for naija.
No be small tin as Jona and di crowd turn "double wahala for dead bodi" to national anthem for di ground.
Ol boy! Evriwia stand still for Oritsefemi as di crowd dey shout say dem want more but di time no kon dey enof since dem go do oda tins.
Wetin kon plate Oga Jona dada welwell na wen Oritsefemi kon sing "Great jonathan"di music wey im compose for di president.
Di president no fit bear di happiness, naim he alla say Oritsefemi must to dey follow am enta evriwia for all him join bodi waka to kontiniu as di president of Nigeria.
He say Oritsefemi teeth complete and he also yarn say di bobo na great musician.
Oritsefemi go dey di next campaign ground for Akure dis week to kontiniu from were he stop.

Wednesday, 7 January 2015

N3000 DON MAKE ONE MAN WAKE UP FROM COMA


One Chinese man, Xiao Li,wey bin dey coma or deep fainting for ova a year now don recently wake up as one of di nurse for di hospital were im for dey receive treatment,sample ram 100-yuan (about N3,000 for naija money).
Xiao Li get dis problem wen he nor gree sleep for some days for one internet bar for Shenzhen, South China guangdong province for August 2013.
Na even last March here naim di guy start to dey respond to treatment.
As he see di money wey dey raise up, naim he stretch hand to pam am from di nurse hand.
Although sha he take am like 5 minutes to grab di money but di doctors say na sign say di guy dey improve and he don comot for coma wey im dey.
Doctors say e go still take some time for dis lucky man to fully recover bifor dem go finally discharge am from hospital.

Tuesday, 6 January 2015

THE WORLD STRONGEST FOOTBALLER NA NIGERIA PLAYER ACCORDING TO FIFA

FIFA Don reveal di world strongest footballer for di world.
We dey proud say na naija boy, Adebayo Akinfenwa wey dey tap leather for AFC Wimbledon, England.
If u no believe, google ram yorsef or

You fit read more here>>>>http://www.bbc.com/sport/0/football/30693977


LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...