MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday, 22 May 2014

POLICE DON ARREST DIPLOMATIC OPJ BICOS E PISS FOR GUTTA

POLICE DON ARREST DIPLOMATIC OPJ BICOS E PISS FOR GUTTA



Ekelebe don arrest Opute Pius Junior A.K.A 'Diplomatic OPJ' of wazobia fm bicos say im piss for gutta for marwa bustop for Lekki,Lagos.Wazobia Fm na one veri popula radio stashon for Naija.di guy bin show im muscle smol as e take police men time to fit arrest am and di mata kon cause heavy go slow for lekki Epe espressway.
The policeman wey carry di mata for head,Sajent Daniel Ighodalo,tok say na offence for Envaromenta sanitashon law of Lagos to bring out your John Thomas for public and piss for anywia u like.
Di mata dey court now as we dey tok and na 2 offence dem say he comit.nomba one bi say he piss for gutta and nomba 2,he show im muscle and power to police say im na boxer.
As dem carry OPJ go Tinubu jojment court for Lagos,di lawya wey joj di mata,Missis Olaitan Ajayi,gree make dem bail OPJ wit 20,000 naira and dem also make sure say im bring pesin wey sign shortee foram and stand for di case wey go continue on di 18 of june,2014.


Wednesday, 21 May 2014

WETIN SEF!ANODA BOMB BLAST DON KILL PLENTI PIPO FOR JOS AGAIN!


WETIN SEF!ANODA BOMB BLAST DON KILL PLENTI PIPO FOR JOS AGAIN!

Bomb wey some wicked pipo hide for inside two bus and shoe market for Murtala Mohammed way,don blow for diferen place and kill plenti pipo for Jos on Tuesday may 20,2014.One of the bomb blast happen 3pm for inside jos main market wey dey around di railway and Jos univasity tishing hospital area.
Na so pipo dey cry,some dey shout,blood dey rush from some pipo nose and bodi as di agent wey dey manage emagenci mata for Naija(NEMA) and Red cross don count and pack about 118 dead bodi alreadi.
We neva sabi di pipo wey do am as nobodi or groop don come out say na dem plant dis bombs but everibodi know for di world say,Naija nomba one enemi,Boko Haram don kill ova 11,000 pipo wit dangerous wipon and plenti bomb for di past 3 years.
Tori wey dey rich us bi say Plateau State governor Jonah Jang and President Ebele Jonathan don condem dis kin nonsense wey hapun for Jos as dem don promise Nigeria say dem go try gbaskele di pipo wey do dis kin wicked tin.













Tuesday, 20 May 2014

YAWA!BRITICO PLANE WEY DEY COME FIND Di GEHS WEY BOKO HARAM KIDNAP DON SPOIL.


Quin Eliza and di Britico prime minista David Cameron go don squiz dia face as Di spy plane wey dem send dey come Naija to come find di chibok skul gehs wey Boko Haram Kidnap since april 14 don kaput for sky.dis one kon make dem do emagenci landing for Senegal.
Some pipo don dey ask weda na Chico plane or Tokunbo plane dem bin dey send come Naija?but anyhow sha dem don dey repair di plane for Senegal as we dey tok.
Dis Royal Air Force Jet bin don take off from Waddington,England dey go Accra for Ghana were dem won base b4 dem notis di folt.
If una rememba last week,Britico Prime Minista David Cameron tok say he go borrow Nigeria sojas and di plane make dem asist to find di ova 200 skul gehs wey Boko Haram siz for Chibok.
Expat pipo from America,France,Britain,Israel don join bodi enta Naija some weeks ago to hep find dis gehs for inside bush.more kontris like Japan,Canada,Australia dey promise to hep fait Boko Haram.



Friday, 16 May 2014

BOMB BLAST FEAR DON CATCH TRADERS FOR BALOGUN MARKET.



Nor bi small yawa race naim shele for around di centra mosk for Nnamdi Azikiwe strit and Tinubu square for Balogun market yesterday as one man wey just dash beggars moni raze alarm say him see one tin wey be like bomb for front of one compini yard for di area.
Nor bi smol tin o,as pipo come dey col dia frends,col dia family say make dem no near dat area for any bizness bicos of di bomb rumor.
Na policemen for bomb mata wey rush come there kon kam di pipo down say make dem no fear say no be bomb di tin be.di bomb expats say di tin na wetin dem take dey patch bodi of ship wey dey leak or ship wey hin bodi don rost.
The pesin wey lead police for dis tok tok na Ngozi Braide.he say di tin no bi bomb at all say wey dem testam,so make dem relax dia mind.Ngozi Braide kon praise di area pipo say dia teeth complete and dem too mosh bicos dem put dia eye for ground to make shor bad bad tins no hapun for dia area.
Too many bomb blast don hapun for Naija for ova 4 years now.di last one na di Nyanya bomb blast for Abuja wey kill ova 77 pipo for garage.
Repot wey dey rich us be say dem don arrest one of di bobo wey plan di bomb attak for Nyanya garage.
Him name na Aminu Sadiq Ogwuche.Na for Sudan dem arrestam and federa govment don dey wok on di paypas make dem fit sendam back to Nigeria to answa him papa name.

OSAZE ODEMWINGIE WIFE DON BORN DIA SECOND PIKIN.






It is a goooooooooooooooal!!!
Shap shoota Osaze Odemwingie don score again!
Him and he wife don dey sing Halleluyah Hossana..as dem don welcome di arraival of dia second boi pikin wey dem name THEO.
Dem don fest get one boi pikin for January,2013 wey him name na NOAH and na ezactly two years since dem marry.
Osaze naim do di braking news by himsef for twita say plus himsef,him wife Sarah,dia fest pikin Noah and di niu bobo,Theo,dem don bicom 4 for di family and he kon tank evribodi for dia congratulashon mesage.
Osaze Odemwigie dey among di playas wey Super Eagles coach Stephen Okechukwu Keshi dey expet to make Naija proud for di world cup wey go shele for Brazil dis june.
Osaze dey play ball for Stoke City for England and he score 7 goals insaid dis season.
As him and he wife don score pikin nomba 2,we pray say he go score plenti goals for us for di world cup for Brazil.

Thursday, 15 May 2014

SKELEWU!!! BET DON CHUZ DAVIDO AND TIWA SAVAGE FOR DIA AWARD FOR OBODO OYIBO.







Omo babolowo,Davido and Shenkes of life,Tiwa Savage get evri rison to dans Skelewu and tank Baba God dis morning as Black Entatayment Telivishon, BET don selet dem among di miusishan wey fit win di Best intanashona catigori(Africa) wey go shele 4 insaid yankee on sunday june 29,2014 for Nokia Theatre  for Los Angeles,Califonia,America.Chai!
Di oda miusishan wey dem go folow drag dis award na Diamond Platnumz of Tanzania,Mafikizolo of south africa,Sarkodie from Ghana,Toofan From Togo.
Ice prince win dis award for 2013,Sarkodie and Wizkid winam togeda for 2012,2face and D'banj nko?dem share dis trophi togeda for 2011.
We for ogakpatakpata.blogspot.com dey wish Davido and Tiwa Savage plenti luck.

Dis na di list of all di miusishan wey dem selet for diferen catigori for 2014

Best International Act: Africa
Davido (Nigeria)
Diamond Platnumz (Tanzania)
Mafikizolo (South Africa)
Sarkodie (Ghana)
Tiwa Savage (Nigeria)
Toofan (Togo) 

Best International Act: UK
Dizzee Rascal
Ghetts
Krept & Konan
Laura Mvula
Rita Ora
Tinie Tempah 

Best Female R&B/Pop Artist
Beyoncé
Janelle Monáe
Jhené Aiko
K. Michelle
Rihanna
Tamar Braxton

Best Male R&B/Pop Artist
August Alsina
Chris Brown
John Legend 
Justin Timberlake
Pharrell Williams

Best Group
A$AP Mob
Daft Punk
Macklemore & Ryan Lewis
TGT
Young Money

Best Collaboration
August Alsina f/ Trinidad Jame$ - I Luv This
Beyoncé f/ JAY Z - Drunk In Love
Drake f/ Majid Jordan - Hold On (We're Going Home)
JAY Z f/ Justin Timberlake - Holy Grail
Robin Thicke f/ T.I. & Pharrell Williams - Blurred Lines
YG f/ Jeezy & Rich Homie Quan - My Hitta

Best Male Hip Hop Artist
Drake
Future
J. Cole
JAY Z
Kendrick Lamar

Best Female Hip Hop Artist
Angel Haze
Charli Baltimore
Eve
Iggy Azalea
Nicki Minaj

Video of the Year
Beyoncé - Partition
Beyoncé f/ JAY Z - Drunk In Love
Chris Brown - Fine China
Drake - Worst Behavior
Pharrell Williams - Happy

Video Director of the Year
Benny Boom
Chris Brown
Colin Tilley
Director X
Hype Williams

Best New Artist
Ariana Grande
August Alsina
Mack Wilds
Rich Homie Quan
ScHoolboy Q

Best Gospel Artist
Donnie McClurkin
Erica Campbell
Hezekiah Walker
Tamela Mann
Tye Tribbett

Best Actress
Angela Bassett
Gabrielle Union
Kerry Washington
Lupita Nyong'o
Oprah Winfrey

Best Actor
Chiwetel Ejiofor
Forest Whitaker
Idris Elba
Kevin Hart
Michael B. Jordan

YoungStars Award
Gabrielle Douglas
Jacob Latimore
Jaden Smith
KeKe Palmer
Zendaya

Best Movie
12 Years a Slave
The Best Man Holiday
Fruitvale Station
Kevin Hart: Let Me Explain
Lee Daniels' The Butler

Subway Sportswoman of the Year
Brittney Griner
Lolo Jones
Serena Williams
Skylar Diggins
Venus Williams

Subway Sportsman of the Year
Blake Griffin
Carmelo Anthony
Floyd Mayweather Jr.
Kevin Durant
LeBron James

Centric Award
Aloe Blacc - The Man
Jennifer Hudson f/ T.I. - I Can't Describe (The Way I Feel)
Jhené Aiko - The Worst
LiV Warfield - Why Do You Lie?
Wale f/ Sam Dew - LoveHate Thing
KELEWU!!! BET DON CHUZ DAVIDO AND TIWA SAVAGE FOR DIA AWARD FOR OBODO OYIBO.

Wednesday, 14 May 2014

YEKPAA! KASALA DON BUSS FOR INSPIRATION FM AS DEM DON SAY BYE BYE TO DAN FOSTER.

Inspiration Fm for inside Lagos don diside to put fullstop to di Kontrat wey dem get wit di Americana,Dan Foster since on Torsday 8 of may,2014.
Dan foster fest wok for Cool Fm b4 inspiration Fm kon tiffam take to wok for dem.
Di tori wey rish us bi say dem forsam to resign instead make dem sackam so dat di mata go get smol respet. Inspiration Fm lidas wey dia Ogakpatakpata na Mr Erastus Akingbola fil say Naija blood and karata don enta him head so him dey denge pose and he nor take di wok serios again.
Dem say di Bobo dey wok like Jakki wen he fest stat di wok but weda na bicos he don drink Naija water or na too mosh generator noiz don change am,we nor kon know.bicos America were him com from, na only farmers dey use generators for inside bush.with generator noiz,anytin can happen.
Akkordin to one worka for di radio station wey say make we nor menshon he name,Dan Foster dey resiv close to 2million naira evri mont if u join all him allawance togeda and yet dem no dey fil him wok again.
Naim dey resiv di bigest salari for di hole of Naija out of all di pipo wey dey work for radio.
He get one time wey evribodi tink say he go marry him forma babe LiNDA iKEJi,one popular Tori writa but he Kon brake di baby heart and marry one banker wey her name na Lovina.Dan and Lovina Don born 3 shidren togeda.2gehs and one Bobo.
No mata how u look di mata rish,plenti of him fans go misam for inspiration fm.
We for Ogakpatakpata.blogspot.com dey wisham gudluck.



LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...