Death,like dem talk am,no get single respect for human being.
Weda u short or tall,weda u black or you be white,weda u rich or u poor.
Di bad news be say,di Olu of Warri don die for Lagos afta 28 years as king.
Akordin to one somebodi wey know about di Olu situation,he say na Friday he die from one sickness wey den neva tell us about.
More tori go come una way later as he take concern di death of di Olu of Warri......
Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Saturday, 5 September 2015
Friday, 4 September 2015
WETIN I TELL MY PASTOR ABOUT THE TYPE OF MUSIC WEY I CHOOSE TO PLAY - CHIDINMA
Miss Kedike and Mtn project fame season 3 winna,Chidinma Ekile,don yarn say,she tell her pastor from day one say, she nor won sing only for church pipo.
She say her miuzik na for evribodi.
Chidinma say evribodi know wetin she sign from day one.
Even her Pastor say if na wetin she want be dat,no shakement,so long say Baba God put hand for her matter.
She say anybodi wey choose to do worldly jam or gospel miuzik,she dey in soport full time bicos na di pesin naim know di undastanding wey he get wit God.

MAHEEDA DON START AGAINNNNNN!!!!!!!!!
Dem born pikin,dem call her Maheeda.
Dem celibrate,pipo chop rice,pipo drink fanta and coke wen dem bornam but nobodi know say she go rugged like dis.
Di kain naked pichors wey dis geh don bring come out,fit make some pastors change mind if Baba God nor call dem for di ministri.
Well,my own na to show una anytime wey she reliz new photo bicos of di naychor of my job.
I nor fit shout!
See for yorsef!

M
Thursday, 3 September 2015
SHUO!!! NA CIGAR DEM TAKE DEY JUDGE WHO BETA PASS BITWIN RONALDO AND MESSI NOW?
Notin pesin nor go see for dis world!
For London street,dem don stat anoda crazy way to take judge who beta pass bitwin Ronaldo and Messi,di argument wey nor dey eva end.
Na Cigar yansh dem take dey judge two of dem now.
Instead of dem to dirty street wit Cigar wey dem don smoke finish,dem dey putam for one showglass wey dem divide.
One side na Ronaldo,di oda one na Messi.
Yor own na to throw di Cigar wey u don smoke finish put for inside,edar Ronaldo or Messi show glass.
Right now,e be like say na Ronaldo dey lead.
Wondament nor go eva end for dis world wey we dey.

Wednesday, 2 September 2015
FORGET WETIN YOU DEY THINK,ME AND RIHANNA NA ORDINARY FRIENDS - LEWIS HAMILTON
Propati of di fast track and car racing,fomula 1 driva,Lewis Hamilton,don dey tell evribodi wey care to listen say,him frendship wit Rihanna nor be wetin pipo dey tink.
For sometime now,na di bobo and Rihanna dey hang out pass.
Dem hang out for New York and Barbados togeda of recent and many pipo dey xpect dis two big names to anounce say somtin dey pipeline.
Last mont,dem two dey togeda like bread and butter for Rihanna kontri,Barbados during di annual Crop Over Festival.
Lewis Hamilton say,even tho say dem dey chill togeda evri now and den,dia bodi nor dey enta magnet mode.
No shaking,i go dey siddon dey watch to bring una tori about dis two celebriti if dia mata later tie wrapper.

Tuesday, 1 September 2015
ROONEY PIKIN,KAI,HANG OUT WITH LIONEL MESSI AND BARCELONA STARS (fotos)
Kai play enta Spain wit him mama,Coleen and he kon go hang out wit Barcelona playas like Messi,Neymar,Luis Suarez and him papa forma team mate,Gerald Pique di man wey oganize di waka.
Na from clap dem dey enta dance.
Make we dey watch how Kai mata go be last last.
BURNA BOY AND CYNTHIA MORGAN DON FALL INSIDE MAGNET
E be like say Cynthia Morgan don dey give fellow reggae and dancehall star,Burna Boy dat German juice wey she dey tell me about.
You no need any oracle or ifa priest to tell you say somtin dey pipeline xcept say pishor dey lie.
Cynthia Morgan post pichor of wen two of dem join dia mouth like magnet,kon dey kiss,dey kiss,dey kiss,like say dia life depend on am.
She kon even fan di fire wen she write on top di foto say,"make we talk truth,make we dey real."
E be like say na Burna Boy she dey tell say make dem stop to lie,make dem yarn di world di truth say dem dey pin demsef down.
Some weeks ago,wen tori pipo from Mtv Base Real talk show,ask Burna Boy who him go like to tap bitwin gentle Chidinma and fire ting Cynthia Morgan,di bobo choose di German juice owner.
He also give dem quik ansa say two of dem (gentle and fire), go good for beta meal too.
Also some weeks ago too,Cynthia Morgan say she nor fit frend any Naija celebriti bicos dem poor pass church rat.
I go siddon for fence dey watch di new tori wey go come out bitwin dis two pipo and I go dey watch too weda na me or na una dem dey fool wit dis foto.

Subscribe to:
Posts (Atom)