MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday, 6 May 2016

SHAYO NA BASTARD! SEE AS BABES PULL DIA PANTS DEY PISS FOR ROAD


Intanet don skata dis word for ground.
Na evritin pipo dey post now?
Is eida dis babes take cocaine or na too mosh shayo put dem for dis mood.
So dem rili tell pesin to snap dem as dem pull dia pant dey piss?
Yes o,no be crime to offload wen di tin hol' you but if e don rish di level of snap and putam for Instagram,make u know say di pipo head nor koret.
May God diliva dem.

Thursday, 5 May 2016

CHECK OUT DI FIRE FIGHTER BABE WEY FINE PASS MAMIWATER


Notin dey give joy rish wen u see fine malawi wey dey hussle some kain hussle wey pipo dey fil say na only man fit do.
Wen u see babe wey be mekanic,u go dey wonda.
Wen u see babe wey be barber,na wondament go just dey do u.
Dis time around na one babe we just diskova say na firefighta work she dey do.
Di malawi soft finish,she fine,she set,her figures nor be here.
Chai!
Her name na Dennis Dooshima.
See di mata for yorsef!


CHIDINMA DON RELIZ HER FIRST PISHORS AFTA SHE LIVE CAPITAL RECORDS


Forma Capital Hills Records First Lady,Chidinma,don reliz some new pichors to take pepper di bobo dem eye.
Akordin to tori wey dey waka pass our doormot,dem say Chidinma just go fil her gas silinda  as she don alreadi start dey cook some kain songs since she liv Capital.
Na wen di food go don we dey wait but bifor den,see more foto wey she bring come out.
See more of her foto dem hia......



Wednesday, 4 May 2016

OYIBO SHA: COURT FOR ITALY DON PASS JUDGEMENT SAY, NOR BE CRIME AGAIN IF HUNGRY MAN TIFF FOOD



Weda na gud news for tiffs or na gud news for hungri men be dis,I nor kon know but sha,I know say di highyest court for Italy,di Supreme Court of Cassation,don yarn say anybodi wey tiff wack as long as he dey hungri,nor be kriminal.
Dem pass dis judgement afta many case of pipo wey tiff bicos of hungri don dey turn somtin else.
For 2011, e get one Italy base homeless guy from Ukraine, Ostriakov wey tiff about N1,200 sausage and cheese wen he go buy breadsticks for supamarket.
Dem sentens di bobo to 6 months for jail but now di Supreme Court don kansow dat judgement on monday afta dem find out say,di 30 year old Ostriakov,tiff di wack bicos he dey homeless and hungri.
If u put dat kain law for naija,na dia you go see pipo wey go dey pack enta all dose expensiv empti hauses for Lekki and dia exkiuz go be,'dem dey homeless and hungri'.
Nationa Assembli,how una see di mata?

PHONE NUMBERS OF OUR GOVNORS FOR NAIJA AKORDIN TO SAHARA REPORTERS


Most of dis govnors na to tiff our money go hide for obodo oyibo banks,buy haus for Dubai,buy beer full fridge and buy motto giv dia girlfriends naim dem sabi.
Odnari N18k minimum wage wey dem sopose to pay,dem nor dey fit pay but if na to carry 2billion go Toronto go buy haus,dem go dey show diasef.
If u know say yor govnor nor dey try,dis na opotuniti for u to call and flash hin battery die as tori pipo,Sahara reporters don giv us di nombas of half of di state govnors.
Pot holes full our roads,no nepa lite,no bore hole,dem don turn our state school fees to somtin else.
No gofment hospita wey man go treat imsef,notin most of dis govnors dey do.
Dem no kia about una.
Di govnors wey dey try nor pass two.
If yor govnor nomba dey appia hia,call am and konplain givam.
Telam about di tins wey he nor dey do well and make we wait and see weda dia brain go reset.
For exampo,dis week,dem cut ova five pipo head for Rivers state and e be like say Gofnor Wike neva hear since he nor dey do anytin about am.
You fit call am telam.
But wait...,u sure say na dia real nomba Sahara reportas giv us so?

Okowa Delta 08056056056,07034081144
Ganduje Kano..08037862149
Rochas Imo..07067777077
Dickson Bayelsa..08033422268
Abubakar Kebbi..07035879790
Ajimobi Oyo...08100000004
Amosun Ogun...08032213993,08068965500
Aregbesola Osun...08024537105,07027789181
Fayose Ekiti..07030000393
Ambode Lagos..07092015444
Wike Rivers..07039600009
Shettima Borno..07065723266
Yari Zamfara..07033412454
Ugwuanyi Enugu..08033129554
Udom Akwa ibom..08022243064
Tambuwal Sokoto..08033155496
Sani Bello Niger..08032000008



Tuesday, 3 May 2016

NA LIE! PEPSi SAY DEM NEVA SACK TIWA SAVAGE, DIA FRENDSHIP STILL STRONG KAKARAKA


Nor be small tin appun last Thursday bitwin Nigeria singa, Tiwa Savage and her forma hosband Tunji Balogun a.k.a Tee Billz as two of dem reliz sikrits of dia marage ploblems for poblik.
Dat dia fight brake record on top YouTube sef as one di tori wey spread fast like strong briz for hamatan.
Tank God say di kain jonalist work wey we dey do for 'Ogakpatakpata', nor be to lie or form tori wey nor dey exist.
Some tori pipo bin carry tori say, Pepsi don sack one of dia ambasador,Tiwa Savage.
Wen dis kain tin disgrace appun sha,di konpini or konpinis wey take u take do dia pasona pesin,so dat u go dey front dia product as a star,fit sack u as dia ambasador.
But Pepsi don come out now say,na heavi lie if anybodi tell u say dem don remove Tiwa name from di list of selibritis wey dem giv rite to carry dia mata for head like lakpalakpa.
Di soft drink konpini say dia frendship wit Tiwa Savage stil dey kankpe,E stil strong kakaraka,inshot dem say dia frendship na 5 and 6.
Pepsi yarn all dis one on top twita so dat me and u go know wia dem stand for di rumor wey dey spred like smoke for town.

CONFAM: Di NEW BEYONCÉ NA FROM AFRICA





Sometimes I nor dey know how to diskraib God and di way wey He dey work.
Jehovah nisi you to bam bam.
All di bammest soprises for dis world na from God.
Anybodi wey dragam,blow tools for hin face.
And anybodi wey judge any book by hin kova,arrestam fast.
Wen I watch dis 18 year old girl vidio of how she take sing America supastar,Beyoncé song,Halo,I shout!
As u dey read dis stori,i stil dey shout as  my koligs for office dey plan to tie me wit rope bicos dem dey feel say I don dey kolo.
Na confam Africa Beyoncé dis babe be.
Her name na Audrey Iteriteka from Burundi.
I nor soprise say Lil Wayne shawa praises for Facebook on top di girl head.
Di bad tin about dis girl life be say she nor get papa,she nor get mama again as two of dem don die.
She dey study modern literature for t Lycée Sainte Theresa Gitega for Burundi.
Nor be say she even take dis miuzik bizness sirios bifor as she dey sing just to entatain hersef but today her stori don dey krip small small enta di world as dem don diskraib her alreadi as di biggest miuzika talent wey Burundi don eva see.
Goodluck to you Africa Beyoncé.
Di world dey wait for you.

Klik and Watch di babe as she dey sing Beyoncé song,Halo


LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...