MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday, 2 July 2016

KANYE WEST WIFE,KIM KARDASHIAN,DON YARN SAY,ANYBODi WEY SAY HER BIG BAKASSi NA FAKE,DEY LIE

Of resent,pipo don akiuz star geh Kim Kardashian say,she dey wear yansh pad just to make her bakassi shoot out.
Dem say di way wey di bakassi be from back wen she attend her sista,Khloe betday for Los Angeles dis week,be like wetin dem load pillow put.
Kim hersef don come out yarn on top her website say,dat na big lie.
She say evribodi don see her yansh welwell for magazines bicos she dey always naked.
Di motha of two say she nor dey wear sholda pad or pillow to make her yansh big.
Na wa o,wetin pesin nor go hia?
Na all dis robish some of our gehs dey copy nawadays bicos dem wan make dia bombom shoot out.
Altho she say her own ikebe na nachora make anybodi nor argiuram.

Friday, 1 July 2016

HUNGA BAD! LISTEN TO Di FUNNY PHONE YARNS BITWIN ONE 419 GUY AND ONE WOMAN

Sharpness na beta tin o.
Like say dis woman nor sharp,na so dis yahoo boy for take do am take.
Na so she for enta one chance for notin.
Make I nor talk too mosh listin to dia stori.
Just click di 419 logo for bottom Hia and listin....

NAIJA DJ,DJ OBI,DON BREAK GUINESS BOOK OF RECORD AS Di DJ WEY DON SPEND Di LONGEST TIME OF 200 HOURS TO PLAY MIUZIK WIT DJ SET

Dj Obi of Nigeria don enta Guiness book of record as di DJ wey don blast jams non stop for ova 200 hours.
Di forma owna of di record na Dj Noberto Loco of Poland.
Wit dis record DJ Obi don join pipo like Kaffy wey don use her dancing skills take enta Guiness record.
Dj Obi na pikin of di late Levi Ajuonuma di forma Group Genera Manager,public affairs division for NNPC wey die for plane crash.

TIMAYA: Di INDIA BOY AND EGBERIPAPA ONE OF BAYELSA

Di Egberipapa 1 of Bayelsa don plasta di area again dis time around ina India stylee.
He put di pichors for Instagram of wia he nack India clothes and di tin nor bad at all for een bodi.
My only only fear na make dis India gehs nor go vex play enta naija come pay Timaya dowry since na babes dey pay dowry for yonda akordin to dia korchor.
Dose babes can trace anybodi enta naija.
We even hia say na dem carry apple from di kontri of Mahatma Gandhi come giv our forma president.
We also hia say dem ovafidam wit di apple naim make am kpai but Timaya sopose know apple wey dem poison if he see one.
Anyway make we dey watch weda we go see dis India tins for hin next Vidio sha.

Thursday, 30 June 2016

YEMI ALADE DON YARN SAY, DEM BEYONCÈ NOR BETA PASS NAIJA MIUZISHANS BUT....

Awards wina Yemi Alade join some oda Africa miuzishan attend dis year BET Awards for Los Angeles.
She yarn on top Instagram say she hapi say she watch miuzishans like Beyoncé,Alicia Keys,Jennifer Hudson,Usher live on stage for one nite.
She say,one tin wey she notice be say,apart from say dis pipo tight,di diferens bitwin dem and naija miuzishans na,di opotuniti wey dem get pass us.
Ok o,we don hia.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...