MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday, 31 May 2014

BRANAMA QUEEN,KEFEE DON COLAPSE FOR INSIDE PLANE FOR AMERICA BUT SHE DEY OK NOW



Di rumors wey dey go round for evri wia now,bi say,Kefee dat fine babee wey sing Branama and Kokoroko,Don kolaps for inside plane as she dey travel go Chicago for America.
Di Sapele water singa,Kefee, neva rich wia she dey go b4 di pilot kon stop for carlifonia make dem for fit carry her go hospita.
Di tori now bi say,di sikness dey veri sirios as pipo say na brain problem naim she get.
But make e no bi like say i dey spread rumors wey I no know weda na true,naim I kon call her phone weda she go pick.but na one guy wey say he name na Kevin naim pick di col.
He tell me say,Kefee travel out of di kontri wit her husband.
Naim i kon askam say,wetin dey do am bicos I dey hia some kain rumors wey no sweet mi for ears.di bobo kon tell me say,na true say she get some problem b4 but she don dey veri ok now.
We pray by God grace say na so e go be.
Kefee don win many award for di miuzik wey she dey play.she just bring one new miuzik come out last week wey she call "Dem go talk"

Kefee and Teddy Don Momoh marry for 2012 and na two of dem naim go one skul wey dem dey call,Chicago Access Network for America last year wia dem for  len how to direct and do koret vidio.na April last month dem come bak togeda from America as dem finish for di skul.

BOKO HARAM DON DEY THIEF VILLAGERS FOOD AS DIA FOOD DON FINISH FOR BUSH.





Report wey dey rich us bi say hunga don dey blow Boko Haram membas as dem don dey come out from bush to town come tiff food.
Dem don kill all di antelope,all di monkey,all di animals for Sambisa forest chop finish and now dem don dey enta town to tiff pipo meat,rice,beans,kpomo,tomatos,bread and even gala wit force.
Even kpakpa sef,Last Sunday,Boko Haram block one bus wey carry bread,kill di driver and di motto boys and dem kon drive di bus face Sambisa Forest.di motto dey come from Gwoza and e dey go Polka but dem kon waylay dem for Wallaba village,kill dem and take di motto.
Tori wey our Tori team gada be say,di food wey dem get nor dey rich dem eat not to tok of di one wey di ova 180 gehs wey dem kidnap go chop.na since April 14 dem kidnap di gehs dem from dia skul for Chibok and Naija army don dey look for di gehs but dem neva stil see were Boko Haram hide dem.oda countries wey join bodi to find dis gehs na,America,Britain,France and Britain.
Akkordin to some of di villagers wey dey stay wia Boko Haram dey go tiff food,dem say,if u see di kain red eye wey dem take dey pack all dia food,somtin go tell u say,e be like say dem won use some of di food take feed di gehs.
But di bad tin be say,akkordin to one man wey dey stay Kamuyya village,afta dem don tiff food and malu finish,instead make dem carry dia wahala go jejeje,na lie!
Dem go kon dey kill pipo,dem go burn down dia shops,burn down dia motto and burn down dia house.
Some of di villa wey Boko Haram dey go tiff food na Limankara, kirenowa,Kamuyya, Kirenowa, Kimba,Makor.

Friday, 30 May 2014

DEM DON CHOOSE ORITSE FEMI, PATORANKING, DON JAZZY, DERELE, GENEVIEVE, TIWA SAVAGE FOR DI 2014 NIGERIAN ENTATAYMENT AWARD "NEA"

Di families of Oritsefemi,Orezi,Pato Ranking,Cynthia Morgan and plenti oda stars don join dem dey tank Baba God and sing "haleluya,hosanna,,,praise da Lord,O singO singO...praise da Lord" as dem don choose dem among di people wey fit win prize for di Nigeria Entatayment Award wey go shele for August 31,2014 for Skirball Centre Performing Arts for Newyork,America.
Oritsefemi get 4 chance to win for,4 diferen catigori,Wizkid get for 3 catigori ,Tiwa Savage(3),Chidinma(3),Olamide(
2)...
To know di miusishans and oda pipo wey dem choose for dis Award,make u checkam for bottom dis place:

Best Actress in a lead role

Nse Ikpe-Etim (Journey to self)
Funke Akindele in Agnetta (O’Mpa)
Damilola Adegbite (Flower Girl)
Chioma Chukwuka Akpotha (Accident)
Daniella Okeke (Lagos Cougars)

Best Supporting Actress

Rita Dominic (Finding Mercy)
Patience Ozokwor (After the Proposal)
Tamara Eteimo (Desperate Housegirls)
Genevieve Nnaji (Half of a Yellow Sun)

Bikiya Graham-Douglas (Flower Girl)
Best Director

Tope Oshin-Ogun (Journey to Self)
Sadiq Mafia (Maja)
Desmond Elliott (Finding Mercy)
Teco Benson (Accident)
Biyi Bandele (Half of a Yellow Sun)

Best Music Video of the year (artist & director)
 Jaiye Jaiye – Wizkid & Sesan
P-Square- Personally
Rands&Naira (Emmy Gee & Nick)

Music producer of the year

Duncan Daniels
Dtunes
Don Jazzy
Blaq Jerzy
Pheelz
Del B
Maleek Berry

Best Rap Act of the year

Olamide
Phyno
Ice Prince
Eva
Show Dem Camp
Reminisce
Cynthia Morgan

Best Picture

Journey to Self
Maja
Accident
Half of a Yellow Sun
Murder at Prime Suites

Best Supporting actor

OC Ukeje (Half of a Yellow Sun)
Rabilu Musa Ibro (Maja)
Desmond Elliott (Finding Mercy)
Yomi Fash-Lanso (Omo Elemosho)
Shawn Faqua (Lagos Cougar)

Hottest Single

Surulere – Dr. S.I.D ft. don Jazzy
Eminado – Tiwa savage Ft. Don Jazzy
Touching Body – J Martins ft. DJ Arafat
Pull-Over -Kcee ft. Wizkid
Double Wahala- Oritshe Femi
Aye-Davido
Caro – Starboi feat Lax & Wizkid

African Artist of the year (non-Nigerian)

Sarkodie
Mafikizolo
Shatta Wale
Micasa
Fally Ipupa
Uhuru
R2Bees
Diaspora Artist of the year
 Stlyzz
Wale Bils
L.A.X
Lola Rae
Mr. 2Kay
Emmy Gee

Best Collaboration –

Daddy-Reminisce/Davido
Solid Star ft Flavor – Oluchi
WanDaMo – Burna Boy ft. Dbanj
Oh Baby – Chidinma Ft Flavour
 Emergency – Wizzy Pro Ft. Runtown, Skales & Patoranking
Gallardo – Runtown Ft. Davido
Allubarika – Patoranking ft. Timaya

Best Actor in a Lead Role

Chitewel Ejiofor (Half of a Yellow Sun)
Kanayo O. Kanayo (Apaye)
Tope Tedela (A Mile from Home)
Joseph Benjamin (Murder At Prime Suites)
Nkem Owoh (Maja)

Best Album of the year

Baddest Guy Ever Liveth – Olamide
Once Upon A Time – Tiwa Savage
Takeover – Kcee
 L.I.F.E – Burna Boy
Jagz Nation, Vol 1: Thy Nation Come -Jesse Jagz
Journey – Sean Tizzle
Blessed – Flavour

Best New Act of the year

Orezi
Patoranking
Runtown
Charass
Tekno Miles
Oritshe Femi
Skuki

Male Artist of the Year

Kcee
Davido
Iyanya
Wande Coal
Wizkid
Oritse Femi
Patoranking

Female Artist of the Year

Tiwa Savage
Yemi Alade
Seyi Shay
Cynthia Morgan
Eva
Chidinma
Niyola

World DJ

DJ IK Nigeria
DJ Shinski Houston
DJ Cuppy UK
DJ Flexx Nigeria
DJ Tunez New York
DJ Spinall
DJ Xclusive

Best R&B artist of the year
Praiz

Tiwa Savage
Wande Coal
Ayoola
Banky W
Chidinma
Harry Song

Entertainment Executive of the year

Efe Omorogbe
Don Jazzy
E-Money
Illbliss
Ayo Animashaun
Steve Babaeko
Okwudili-umenyior

Funniest Comedian of Year

Bovi
Bash
Funny Bone
Ajebo
Akpororo
Helen Paul
Chi Girl

Indigenous Artist of the year

Oritshe femi
Reminisce
Sean Tizzle
Jaywon
Flavour
Timaya
Mc Galaxy

Entertainment Personality of the year

Toolz
Liz Yemoja Adams
Toke Makinwa
Denrele – Channel O
Lami – Nigezie
IK Ogbonna

Gospel Artist of the year

Tim Godfrey and Xtreme Crew
Frank Edwards Flo
Segun Oluwayomi
Niki Laoye
Sabina Proverbs

Most Promising Act to Watch-

Di’Ja
Ayo Jay
Elphlex
Koko J
Sna-Z
Brain
DJ Mo






D'BANJ DON WIN OGBONGE PRIZE FOR WORLD MUSIC AWARD


All of una wey dey yarn say,since D'banj liv Don jazzy and Mohits rekord,na so so opata and rubish e dey sing,di oganaizas of one Ogbonge award wey dem dey call 'Di World Music Award,tok say,na big lie una lie as dem chuz D'banj as di Africa nomba one!
For di award wey dem do for Monte Carlo,Monaco, for inside France,dem say di Eja nla,D'banj, naim bi di nomba one miuzishan wey he miuzik dey sell pass for di hole of Africa,so diafor,if bad belle pipo wan to hug transforma,dem dey veri free.
Di Kokomasta win oda Africa miuzishans like Banky W,Fally Ipupa,wizkid and Davido.
Even kpakpa sef,D'banj paform for stage for di award.oda miuzishan wey paform dat day na Miley Cyrus,Jason Derulo,Mariah Carey and plenti odas.

TO KNOW DI MIUSISHAN WEY WIN AWARD DAT DAY,  CHECKAM FOR BOTTOM DIS PLACE:

World-s best-selling Recording Act – One Direction
Worlds Best Male Artist as voted on by fans – Han Geng
Worlds Best Group – One Direction
Worlds Best-selling recording Act – One Direction
Worlds Best Pop Act – One Direction
World’s Best Pop Rock Male Artist – Justin Timberlake
Worlds Best Pop Rock Female Artist – Miley Cyrus
World’s Best Rock Act – Imagine Dragons
World’s Best R & B Act – Beyonce
World’s Best Rap/Hip Hop Act – Eminem
Worlds Best Alternative Act – Lorde
Worlds Best Alternative Group (voted by the fans) – Fall Out Boy
World’s Best EDM Act – Daft Punk
Worlds Best EDM Artist (voted by the fans) – Avicii
Worlds Best New Artist – Lorde
Worlds best Video – Miley Cyrus

LEGEND AWARDS

Greek Legend – Sakis
Latin Legend – Ricky Martin
Outstanding Contribution to Dance Music – Flo Rida
Icon Award – Mariah Carey
Best selling singles artist in America – Mariah Carey

Best female as voted on by fans Miley Cyrus

NATIONAL BEST-SELLING ARTISTS

Best-selling American Artist – Eminem
Best-selling Australasian Artist – Lorde
Best-selling Azerbaijan Artist – Emin
Best-selling Benelux Artist – Stromae
Best-selling Canadian Artist – Michael Buble
Best-selling Chinese Artist – Chris Lee
Best-selling British Act – One Direction
Best-selling French Artist – Daft Punk
Best-selling German Artist – Helen Fischer
Best-selling Indonesian Artist – Anggun
Best-selling Italian Artist – Ligabue
Best-selling Korean Act – EXO
Best-selling Latin Artist – Shakira
Best-selling Japanese Artist – AKB48
Best-selling Philippines Artist – Sara Geronimo
Best-selling Portuguese Artist – Tony Carreira
Best-selling Russian Artist – Grigory Leps
Best-selling Scandinavian Artist – Avicii
Best-selling Spanish Artist – David Bisbal
Best-selling African Artist – D’Banj

Thursday, 29 May 2014

NOLLYWOOD OGA,CHARLES NOVIA,DON FINISH TIWA SAVAGE WITH CURSE


 One of di big Oga for film and home vidio mata for
Naija,
Oga Charles
Novia,don finish Tiwa Savage and her husband Tee
Bills wit curse just di
way wey Ajegunle musishan,Nico Gravity,take finish
Timaya with curse for 2011.na for inside twitta he for curse dem afta im watch di vidio for di
new miuzik wey Tiwa Savage just bring come out.
One of Nollywood oga,Charles Novia say,sake of say
Rihanna and Beyonce dey
open yansh and breast for Tv,Naija gehs won open
dia own too.he say,fear nor fit allow pipo put on dia Tv again to watch
Nigezie,Soundcity,hip
Tv,Music africa and oda Naija miuzik stashon sake
of say,Naija miuzishan
dey do like say na blue film dem dey do nowadays
for inside dis miuzik wey dem dey play.
Novia also tok say,im na big fan of Tiwa Savage,but
for dis her new miuzik
wey she bring come out so,she no try at all bicos say
she just dey torch
her website anyhow and she kon dey wine body (like) mamiwater and ashawo.he
say Maheeda crase dey learn for wia Tiwa own dey
and even tho Tiwa won
crase,she supose to crase for dia bedroom for only
her husband.
Akordin to tori wey we gada,Charles Novia also tok say,if to dey open John
Thomas and Website for evribodi to dey see na gud
tin,den,make dem no wear
dia pikin any clothes for bodi and make dia shidren
dey naked go skul.

Di Oga kpata kpata for Manchester United, Malcolm GLazer, don die


Di man wey get Manchester United Malcolm Glazer
don die for im house for
Rochester for inside New York,America.
Glazer buy Man U for 2005 and for dis period dem
win 5 primia lig 4 England
and one champions lig 4 Europe.Naim also get di America football lig
team,Tampa Bay Bucaneers.he don get stroke since
2006 and he kon die today
at di age of 85.
Even united later bring out yarns say dem dey
veriveri sad say di man die but e death no go stop Man u to kontiniu to exist as
im pikin,Joel and
Avram Glazer don even dey run di club since as Vice
Chairmen for ova 9
years now.
But sha o,b4 Glazer die,e no eva visit Old Trafford.weda na to come wash
mash o, or to come grit di playas o,e no go dia
anytime.
Old Trafford naim bi di field wey Man u for dey play
all dia home mash.

Wednesday, 28 May 2014

NAIJA SOJAS SAY DEM DON LOCATE Di KIDNAP CHIBOK SKUL GEHS



Di Ogakpatakpata 4 securiti mata for Naija,Air Chief Marshal Alex Badeh,tok say dem don see di place wia dem hide di Chibok skul gehs wey Boko Haram kidnap.he tok dis one wen he dey kul di mind of di crowd down wey carry protest come he office.he say na sense dem take dey katch monkey,so diafor, Naija sojas nor go use force to free di gehs make e no go kos big wahala sake of say,if dem use force,di gehs dem fit die since Boko Haram don alreadi soranda di gehs dem wit bigbig guns and dangerous wipons.
Dis tori,go giv di gehs dem mama and papa smol hope but Chief Badeh say dem nor go fit tell anybodi wia di gehs dem dey for now since na di sikrit wey dem go take kontiniu to dey work and look for di gehs.
Tori wey our tori team also gada be say,President Goodluck Jonathan don cancel di plan wit Boko Haram to free di gehs.di plan b4 bi say,federa govment sopose to free about 100 Boko Haram membas wey dey prison,den,Boko go come free di Chibok skul gehs.but Jona phone from France wia he go do one join bodi meeting wit im felow ogakpatakpata from oda kontris about dis Boko Haram wahala,say,make dem put fulstop to dat deal.
Di rizin bi say,if dem do dis kain bizness wit Boko Haram,e go giv dem high spirit to kontiniu di kidnaping,di killing and do more wickedwicked tins.
Di konclushon now bi say,since Naija sojas no won use force, federa govment don deside to borow sense from all di monkey for inside bush,make dem use am take free and #BRINGBACKOURGEHS.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...