Baddest produca and Ogakpatakpata of Mavin,Don Jazzy,don yarn goldmyneTV say, for one good year he neva near him house for Nicon Town.
He say im get 8 bedroom office for Lekki and naim studio for dia him dey stay since.
Don Jazzy say all im clothes dey dia,na dia him dey stay,na dia him dey shit and evritin dey dia foram.
Don Baba J also yarn say,him still dey enjoy im work and him get two producas for him camp.
Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Friday, 21 August 2015
Thursday, 20 August 2015
Di FINE ANSWER WEY I GO GIVE FLAVOUR NABANIA IF HE SAY HE WON BE MY BOBO NA....
Miss kedike,Chidinma,don yarn tori pipo plenti tins about her love life.
She say di rizin why she still dey single na maybe she neva see di man wey God krate foram or maybe na di man neva siam.
She yarn say notin for all her plenti man frends dem bicos na odinari frends dem be toram.
She say many stars dey die foram and she fill say by now dem go don finisham for ground wit dia plan but di truth be say she nor get anytin wit dem.
Pipo don dey link two stars name to chidinma as bobos wey she don date.
She say di kain frend wey she be wit soundcity presenta,Adams,na di kain one wey be say if dem see,dem dey even insult diasef.
Chidinma say she no soprise as dem say Adams na her boyfrend bicos dem dey veri close.
As for Flavour wey pipo dey suspect say dem dey do kelekele love,she say notin join dem apart from miuzik.
She say if Flavour open mouth say Chidinma be my sweetie porero,she go tellam capita "NO".
You no go blame pipo wey dey suspet two of dem bicos dem don see dem dey kiss for vidio,dem don see dem for wicked wicked ikoro.
Two women,Sandra and Anna Banner don alreadi born for Flavour.
Maybe Chidinma dey try to use her brain.

Wednesday, 19 August 2015
ORISIRISI! LANDLORD BUILD ONE STORY BUT FORGET TO PUT STAIRCASE
If dem tell you say pesin dey wey fit foget im name, make u no doubtam.
Di landlord wey get dis stori building don show say plenti pipo dey wey fit foget wia dem dey stay as he build dis stori building but foget to include step to take dey climb go up.
Na ladder dem put to dey climb go
Abi na money finish or he foget, I no kon know.
God hep yor shidren.

Tuesday, 18 August 2015
G-WAGON FEVER:IN ONE WEEK THREE NAIJA STARS BUY THREE G WAGON(fotos)
Na G-wagon be di new motor for naija stars?
Inside dis week three celibritis don show us say na G-wagon be di new ting.
Last week i sell my G-wagon and Timaya pose wit him G-wagon dis week.
Pato Ranking sef pose wit him own and now Ayo Makun,AY,don buy one for imsef to take celibrate him birthday today.
Oda pipo wey get G wagon na,Olamide,Yemi Alade,Davido,MI,Zaki Adzee and plenti odas.
Who dey next?

MERCY JOHNSON DON CARRY BELLE 10 MONTHS AFTA SHE BORN HENRY
Dis one no be dem say,dem say akordin to tori pipo wey dey wia nollywood actress dey shoot her new film "Eviction day",confam say she don carry anoda belle 10 months afta she born her last pikin.
Vitus Nnebue naim dey produce,Afe Olumowe Pictures Image dey direct and faces like Nkem Owoh, Isabella Ayuk, Uche Odoputa, and many odas dey dis home vidio.
Di belle don reash di stage wey she no fit hide again as e don dey show for any dress wey she wear.
Mercy Johnson and Prince Odianosen Okojie marry for 2011 and dem don get two pikins alreadi.
Purity(girl) and Henry wey be boy.
Congratulabia Mercy.

Monday, 17 August 2015
DON JAZZY,REEKADO BANKS,ORITSEFEMI,DJ LAMBO AND ALL OTHER WINNAS FOR DI CITY PEOPLE AWARDS
Di nomba 6 edition of di City People Entertainment Awards don come and go.
Di awards appun on Sunday August 16 for Time Square Event Centre for inside Lagos and na to take recognise pipo wey dia talent show pass for dis year.
Check out di list of all di winnas for bottom hia:
Music Label of The Year
Mavin Records
Special Recognition Award
Don Jazzy
Best Promising Act Male
Reekado Banks
Best Promising Act Female
Simi
Comedian Of The Year
Seyi Law
Best New Act (English)
Lucas Ozeokwu
Most Promising Female Actress (English)
Ofiere Tessy
Best Movie Marketer
Magic Movies
Best Supporting Actress
Angela Okere
Best Actor Of The Year
Ken Erics
Best Music Band
Sugar Band
Lifetime Achievement Award
Clarion Chukwurah
Special Recognition Award
Kenneth Okonkwo
Best Dancehall
Oritsefemi
Best Supporting Actor (English)
Ken Okoli
Best Movie
30 Days In Atlanta
Best Director
Lancelot Imasuen
Special Recognition (Gollywood)
Soni Uttaji
Best Movie producer (Yoruba)
Femi Adebayo
Best Actor Of The Year (Yoruba)
Odunlade Adekola
Nollywood Face of The Year
Kate Henshaw
Special Recognition Award
Shina Peller
Hottest Ghanaian Actress In Nollywood
Juliet Ibrahim
Kannywood Personality of The Year
Ali Nuhu
Best Production
Fly Birds
Best Supporting Actress (Ghana)
Sonya Ibrahim
Best New Actress (Ghana)
Adusakowa Regina
Yoruba Personality of The Year
Mercy Aigbe-Gentry
Gollywood Showbiz Company of The Year
Jack Daniels
Most Promising Actor of The Year (Yoruba)
Akin Richie
Best Supporting Actress (Yoruba)
Mojisola Olaiya
DJ of The Year
DJ Lamboghini
SHINA RAMBO DEY LAFF WIZKID BICOS AKON BRODA CALL AM,"KING OF NIGERIA"
Na dis one dem dey call yanga dey sleep trouble go wake am.
If u dey follow Wizkid tori,u go know say him get bad mouth pass even pepeye.
Ask Saeon,ask Skales.
Also ask dat boy wey Wizkid yab for instagram say; poor pipo always dey tink say dem get opinion sake of say he try koret Wizkid bad inglish.
Sina Rambo don dey laff just bicos Akon broda,Bu Thiam put di pishor of Wizkid for instagram and say,“The King of Nigeria, WizKid Album in stores Now!!”
Sina Rambo see di tori naim he rosh coment on topam wit dis laffin sign,"Lmao (laugh my ass out)".
Sina Rambo di HKN gang rappa,na cousin to Davido and Wizkid na Davido biggest rival for di industri.
Weda Wizkid go reply Sina Rambo,na dat one we neva know.
Make we dey watch.

Subscribe to:
Posts (Atom)