Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Wednesday, 13 July 2016
WONDAMENT AS ONE BABE FOR INSTAGRAM DEY BEG JIM IYKE SAY MAKE DEM DO DAT TIN JUST ONCE
Na wa for wire road o.
Intanet don dey make many pipo dey mad o.
One babe wey her name na Chichi for Abuja nor even kia weda pipo go read wetin she rite as she dey beg Jim Iyke make di bobo kon test her somtin.
Akordin to di babe she say make dem do am only once so dat she go fit comot Jim Iyke mata from her head.
Jim Iyke,in case u finalli dab di babe,abeg let us know weda fried rice and ketch up dey inside her own.
Robish?
Our gehs nor get shame again o!
Wot if her boyfrend ridam or her papa dey stroll pass Instagram?
If I hear God wan destroy di world,if I begam,make I die.
Yeye dey smell!
Tuesday, 12 July 2016
ONE TWITA BOBO DON YAB BUHARI SAY,HE DiSiV US DURING CAMPAIGN WEN HE DEY DRINK N40 MILO BUT NOW HE DON DEY WEAR N223,905 SHOE
Politiks sha!
Dat time wey Buhari and Osinbajo dey kanpain,I rememba for dat joinbodi sidon wen we see dem dey shack 40 naira milo for brake fast.
Akordin to one twita user,he say dat one don 'change' now as Buhari don dey wear xpensiv tins now like di N223,905 Gucci shoe wey hin wear take step out of resent.
He yab Buhari nor be small.
But Buhari own stil beta bicos he nor tell us during kan pain say he nor get shoe like one of our forma presido.
Na wa o.
Me i wan be president too o,so dat I go fit dey afford xpensiv rat kila.
HIAN! WETIN LINDA IKEJI DEY DO FOR CHARLY BOY LAP?
Tori queen,Linda Ikeji,di babe wey love island bananas,don kack on top Charly Boy lap snap foto.
Who dey sidon for Area Fada lap go free?
Linda?
Be kiafu o!Area Fada nor be gentleman at all o.
E get selebriti laps wey dem nor dey carry sidon put.
2face na one of dem,Flavour na anoda one,Wizkid join,Area Fada dey among.
If I say make I kontiniu,di list nor go end.
But Linda wait o! Wia una for take dis foto?
Monday, 11 July 2016
HARRYSONG FANS DON FINASHAM WIT CURSE FOR INSTAGRAM SAKE OF SAY HE DRAW LIPSTICK LIKE WOMAN
Okoro feeling funky get why he choose to dey funky.
Harrysong go don dey regret why he go try to feel funky like okoro by drawing lipstick for lips.
Di bobo fans nor waste time to finisham on top Instagram wit curse.
Some even say na gay style be dat as dem nor hapi to siam rob lipstick.
Nor be only lipstick dem akiuz am of robin.
Dem also akiuz am of putting foundation for face.
Harry,abeg konsetrate for yor miuzik and live trash for Lawma.
HARRYSONG FANS DON FINASHAM WIT CURSE FOR INSTAGRAM SAKE OF SAY HE DRAW LIPSTICK LIKE WOMAN
Okoro feeling funky get why he choose to dey funky.
Harrysong go dey regret why he go try to feel funky like ojoro by drawing lipstick for lips as he fans on top Instagram finisham wit curse.
Harrysong go dey regret why he go try to feel funky like ojoro by drawing lipstick for lips as he fans on top Instagram finisham wit curse.
Sunday, 10 July 2016
QUARREL DON START AGAIN AS PAUL OF PSQUARE PAFOM ALONE FOR CONGO BICOS PETER REFUSE TO GO
Bifor,we bin tink say Psquare kworel na skamin but afta wetin appun dis week wen Peter tell di oganaizas of dia Congo show say,him nor go atend di show,na now we don know say all dis dia kworel na real kworel.
Di last time Peter talk say,dia sinior broda and manager wey be Jude,must stop to be dia manager for peace to reign.
But dem settle dat one.
Now Jude don book show again and fresh gbege don start.
Afta Peter say him nor know about di Congo show,video evidence show say,na lie he lie bicos he even join Paul promote di show for di vidio.
Watch di vidio evidence for botom hia..
Last nite,na only Paul pafom for di show for Congo and he reliz pichors and vidio of hin pafomans for di show and he nor
Di tin don too much.
Make dem kuku brake up make dia fans rest.
Dem go kworel,dem go settle,dem go kworel,dem go settle.
God sef go don tire for dis dia kworel.
If u ask me,I biliv say dis na di end.
Maybe di next tin wey we go hia now go be,dem won share propati.
Watch Paul solo pafomans fo botom Hia...
Subscribe to:
Posts (Atom)







