MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday, 4 December 2014

M.I TO SAEON:WIZKID DEY RIGHT, BIZNESS NA BIZNESS


Mr incredible imsef, M.I, don shook mouth for di quarel bitwin Wizkid and Saeon.
If you rememba, few months ago, Saeon blast say,Wizzy no send her song,"Boogie down" wey two of dem sing as he neva one day promote am for twitter or facebook.
Wizzy sef kon reply am say, di job wey dem payam to do naim he do, so diafor, make evribodi free am.
Now di short blackboi imsef,M.I say pasonally,im feel say Wizkid no do wrong since na bizness naim bring dem two togeda.
M. I say Saeon dey veri wrong as she kon dey yarn about dia bizness deal for public.
He say as for him, he no dey charge pipo for collabos but dat one no mean say if pesin kon meet im managers for bizness dem go rejectam.

Wednesday, 3 December 2014

GANGNAM STYLE DON BREAK YOUTUBE


Na small tin remain, YouTube for crash as di South Korea pop artiste, Psy,don force dem to upgrade dia system as him monsta hit, Gangnam style vidio don pass over 2,147,483,647( over 2.1 billion) views. 
Google, di owners of YouTube, for one of dia blog post, release statement say dem no believe say pipo go watch any vidio reach like dat. 
As di mata be now, Google don upgrade dia 32-integer so dat dem go fit witstand any more clicks for di Gangnam style vidio.

HALLELUYAH!!! NEW DRUGS TO MAKE YOUR MESS DEY SMELL LIKE CHOCOLATE DON DEY NOW

CHRISTIAN POINCHEVAL
My brodas and sistas, now you fit make yor anus di talk of di town dis christmas season.
For di fest time in di history of di world, to dey mess go dey make sense now bicos, one man from France,Christian Poincheval wey im frend almost kill with mess wey dey smell like kabad and soup wey don sawa for 40 days, don vex make one merisin wey go make yor mess dey smell like chocolate and habiscus flower or even dey smell like stew wit korect curry smell.
He say, since di gas attack nearly kill pipo for di restaurant dat day, naim he vex say he must do someting about smelling mess.
For dose of una wey una mess dey smell like pesin wey neva go toilet for 9 days,from today, yor worriment don end bicos akordin to Poincheval, he say na 100% natural plants and ingridients naim he take make dis merisin.
Di site wey dey sell dis merisin, don take advantage of di season dey call am "Di Father Christmas mess merisin", even though Poincheval neva givam name.
Since pipo dey eat more during holiday piriod, dis drug go make sense dis season.
And if you don dey crack yor head for di kind of gifts wey you go buy for yor frends and family dis Xmas, no worry yorsef again as dis mess cure merisin, na di pafect gift.

CHECK OUT MIKEL OBI AND RICH IN-LAWS TO BE

Forget say Super Eagles and Chelsea star, Mikel Obi no dey get enuff playing time for Chelsea, but he dey get enuff time to play wit im Russian chikito, Olga Diyachenko and even find time to hang out wit her family wen di babe celebrate her birthday.

Spending time for Chelsea bench no dey givam joy,but if u see Mikel di way wey im take dey shine teeth since he stat to release all dis photo dem, u go know say, di babe dey givam joy.









Tuesday, 2 December 2014

DESMOND ELLIOT DON WIN APC HOUSE OF ASSEMBLY PRIMARIES FOR LAGOS STATE


Nollywood and home vidio star, Desmond Elliot,don chook one leg put for Lagos house of assembly as he don win di APC primaries wey dem conduct today for Lagos state as he defeat di two times defending champion,Kabiru Lawal for Surulere constituency.
Wit dis victory, Desmond Elliot go represent APC for next year house of assembly election.
Meanwhy, luck no shine on musician Kenny Saint Brown,as she loose di chance to represent APC for Ikeja constituency as she lost to APC mouthpiece, Lai Mohammed son,Folajimi Mohammed.
We go bring una more result as we dey getam.

Monday, 1 December 2014

ALLEGED NAMES OF HOUSE OF REPS MEMBERS WEY WANT MAKE DEM IMPEACH PRESIDENT GOODLUCK JONATHAN

Kporkporkpor! Kporkporkpor! Kporkporkpor!

Impeachment! Impeachment! Impeachment notice knocking for President Jonathan door.
President Jonathan
For life, dem say anytin can appun.
If you find out say PDP replace President Goodluck Jonathan name wit some one else name for di 2015 Presidential Elections, make you know say na di following house of rep membas naim make am posibo as dem don dey sign to make uncle Jona cry blood next year akordin to sources.

Oya See di alleged names for bottom hia:

1-Hon. Bethel Amadi
2-Hon. Nkeiruka Onyejiocha
3-Hon Nnenna Ukeje
4-Hon Aliyu Madakin Gini
5-Hon. Ugochukwu Ohajuruka
6-Hon Chinwe Ubani
7-Hon. Chinyere Ike.
8-Hon. Uzo Azubuike.
9-Hon. Udo Ibeji
10-Hon. Arua Arunsi.
11-Hon. Nkem Abonta.
12-Hon. Mulikat Akande
13-Hon. Leo Ogor
14-Hon. Kwaga Ganama
15-Hon. Anthony Madwatte.
16-Hon. Gibson Nathaniel.
17-Hon. Francis Hananniya.
18-Hon. Fons Nwangubi.
19-Hon. Aisha Dahiru.
20-Hon. Emmanuel Ekpenyong
21-Hon. Friday Udoh.
22-Hon. Akpan Umoh.
23-Hon. Robinson Uwak.
24-Hon. Emmanuel Ukoette.
25-Hon. Edet Achibong.
26-Hon. Emmanuel Ekon.
27-Hon. Akpan Effiong.
28-Hon. Ini Udoka.
29-Hon. Bassey Dan-Abia.
30-Hon. Chizor Obidigwe.
31-Hon. Victor Ogene.
32-Hon. Chris Azubogu
33-Hon. Chukwuemeka Nwogbo.
34-Hon. Ben Nwankwo.
35-Hon. Uche Ekwunife.
36-Hon. Chriscato Amete.
37-Hon. Cyril Egwuatu.
38-Hon. I feanyi Dike.
39-Hon. Azodo Eucharia.
40-Hon. Tukur Adamu.
41-Hon. Isa Mohammed.
42-Hon. Auwalu Saleh.
43-Hon.Nuhu Abdulrazak.
44-Hon. Jatau Auwal.
45-Hon. Misau Ahmed.
46-Hon. Umar Sade.
47-Hon. Madaki Gololo.
48-Hon Warman Ogoriba.
49-Hon. Foingha Jephtah.
50Hon. Daniel Ofongo.
51-Hon. Nadu Karibo
52-Hon. Stella Dorgu.
53-Hon. Samson Okwu.
54-Hon. Awulu Adaji.
55-Hon. Hassan Saleh.
56-Hon. Echopu Enthonu.
57-Hon. John Yegh.
58-Hon Emma Jim.
59-Hon. Christina Alaaga.
60-Hon. Hembe Iorwase.
61-Hon. Benjamin Aboho.
62-Hon. Emmanuel Udenbe
63-Hon. Terfa Ityar.
64-Hon. Kaka Gujbawu.
65-Hon. Ibrahim Khadi.
66-Hon. Isa Lawan.
67-Hon. Peter Biyeh.
68-Hon. Rose Okoh.
69-Hon. Daniel Effiong.
70-Hon. Nkoyo Toyo.
71-Hon Francis Busam Addah.
72-Hon. Ewa Bassey Ekoh
73-Hon. Sunday Ettah.
74-Hon. John Enoh.
75-Hon. Essien Ayi.
76-Hon. Ogbaburhon Austin.
77-Hon. Nwokolo Victor.
78-Hon. Emediese Akpodiogaga
79-Hon. Daniel Reyemeju.
80-Hon. Mutu Ebomo.
81-Hon. Ndudi Elumelu.
82-Hon. Evelyn Oboro
83-Hon. Enekorogha Francis.
84-Hon. Ossai Ossai.
85-Hon. Okwuru Tobias.
86-Hon. Linus Okorie.
87-Hon. Omo Isu
88-Hon. Sylvester Ogbaga,
89-Hon. Peter Ali.
90-Hon. Peter Onyemaechi.
91-Hon. Jim Adun.
92-Hon Pally Iriase.
93-Hon. Peter Akpatason.
94-Hon. Nosakhare Osahon.
95-Hon. Abubakar Momoh.
96-Hon. Jones Onyeriri.
97-Hon. Patrick Ikhariale.
98-Hon. Friday Itulah.
99-Hon. Samson Osagie
100-Hon. Oyetunde Ojo.
101-Hon. Michael Bamidele.
102-Hon. Stella Ngwu
103-Hon. Toby Toby.
104-Hon. Oforbuike Chukwuegbo.
105-Hon. Asadu Oziokoja
106-Hon. Ogbuefi Ozomgbachi.
107-Hon. Peace Nnaji.
108-Hon. Ifeanyi Ugwuanyi.
109-Hon. Kingsley Ebenyi.
110-Hon. Isa Egah.
111-Hon Jisalo Bitrus.
112-Hon. Khamisu Ahmed.
113-Hon. Yusuf Manu.
114-Hon. Binta Bello.
115-Hon. Usman Kumo.
116-Hon. Shuaibu Galadima.
117-Hon. Umar Ahmed.
118-Hon. Eddie Mbadiwe.
119-Hon. Chudi Uwazuruike.
120-Hon. Jerry Alagbaoso.
121-Hon. Ezenwa Onyewuchi.
122-Hon Gerald Irona.
123-Hon. Bashir Adamu.
124-Hon Yusuf Dunari.
125-Hon. Mustafa Khabeeb.
126-Hon. Sabo Nakudu.
127-Hon. Ibrahim Garba.
128-Hon. Hussein Abdulkadir.
129-Hon. sh*tu Galambi.
130-Hon. Safiyanu Ubale.
131-Hon. Wada Usman.
132-Hon. Tijani Ibrahim.
133-Hon. Adamu Hassan.
134-Hon. Shehu Garba,
135-Hon. Yakubu Barde.
136-Hon. Abbas Tajudeen.
137-Hon. Yusuf Bala.
138-Hon. Jagaba Jagaba.
139-Hon. Ibrahim Lawal.
140-Hon. Simon Arabo.-
141-Hon. Gwani Gideon.
142-Hon. Godfrey Gaiya.
143-Hon. Ibrahim Mustapha.
144-Hon. Isa Ashiru.
145-Hon. Tijjani Abdulkadir Jobe.
146-Hon. Farouk Lawan.
147-Hon. Munir Babba
Danagundi.
148-Hon. Bashir Galadanchi.
149-Hon. Abdulsalam Adamu.
150-Hon. Dawaki Bala.
151-Hon. Aminu Sulaiman Goro.
152-Hon.Kawu Sumaila.
153-Hon. Danlami Garba.
154-Hon. Sani Auwalu.
155-Hon. Garba Gulma.
156-Hon. Ibrahim Kamba.
157-Hon. Kalgo Muhammed.
158-Hon. Aminu Musa.
159-Hon. Abdullahi Dan-Alkalli.
160-Hon. Garba Uba.
161-Hon. Halilu Aliero.
162-Hon. Bello Kaoje.
163-Hon. Tom Zakari.
164-Hon. Muhammed Idris.
165-Hon. Ayo Yusuf.
166-Hon.Sunday Karim.
167-Hon. Ahmed Tijjani.
168-Hon. Isma’il Hussain.
169-Hon. Abdulrahman
Badamasi.
170-Hon. Umar Jibril.
171-Hon. Sadiq Muhammed

SINCE EMMANUEL ADEBAYOR CALL OUR MAMA WINCH, NA SO SO CRY SHE DEY CRY-KOLA ADEBAYOR


Kola Adebayor, Emmanuel Adebayor senior broda,don yarn say di Tottenham striker don brake dia mama heart since he call am winch.
Kola say na so so cry dia mama dey cry since one fake babalawo tell Adebayor say dia mama and  dia sista, Mageret dey do juju and otumokpor to kill im football career.
Kola, wey be truck driver for Bremen, Germany, tell The Sun on Sunday say, dis same babalawo dem, dem don wash di guy brain sotey dem dey prophesies toram bifor he score goals and also dey yarnam why he no dey play well.
Kola say, "my mama dey veri sad.na evriday she dey cry.I call am for phone just now and she just dey cry steady."
KOLA BACK THEN WITH RASTA DADA, TAKE POSE WITH
MAMA AND LATE PAPA ADEBAYOR
If u still rememba our stori almost two weeks ago,we tell una say, Emmanuel Adebayor yarn one radio station for Ghana say he mama dey try to kill im destiny with juju.
Di tori wey we even gada be say he don even drive di mama comot for im house bicos of dis mata.
Meanwhy, Adebayor coach no select am for di match wey im club, Tottenham Hotspur play and win 2-1 against Everton yestaday.
Even last week too di coach no look im face for di match wey dem play and also win against Hull City 2-1.
KOLA AND EMMA ADEBAYOR WEN DI GOING DEY SMOOTH

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...