Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Saturday, 6 August 2016
FUNNY ACTOR CHARLES AWURUM,DON YARN SAY,HIM GIRL FRIEND MAMA CANCEL DIA MARRIAGE PLANS BICOS HE NOR BUY GENERATOR FOR DEM
Funny and mumu Nollywood actor,Charles Awurum,don yarn Tori pipo say,her forma babe mama play wicked role for dia relashonship wey krash like pack of cards.
Di funny man say,'i beta pass my neighbour generator' wey him nor buy for dem,naim make di babe mama hate am.
Dem don fix di date for di tradishona wedding finish bifor di mama telam say di union nor go work.
Di whole gbege akordin to Awurum start wen he go visit hin babe for dia house.
Dat piriod him stil dey stay one room for Enugu.
He say as he rish dia house,NEPA don alreadi seize dia light.
Mouth kon go skratcham ask dem say,why dem dey darkness?
Naim di babe mama rush telam say "make he buy dem generator".
He kon use joke tell di mama say,"di pesin wey u want make he buy una generator so,u don askam weda hin get generator"?
Charles Awurum say since dat day,di mama nor wan use eye siam.
Di mata kon rish one level,naim dem vex carry di babe go Lagos just to diskonet dem.
Afta evritin,two of dem later jam for Lagos again and na dis time dem fix date for di tradishona tins.
Bifor u go say,siddon look na dog name,di mama don para say di marage nor go work.
Di exkiuz dis time be say,famili say dia daughta must marry pesin wey come from dia village.
Awurum say wetin pain am pass be say,di babe kon dey soport di mama.
Di bobo say na so dem take brake hin heart for ground o.
He look up,he look down,naim he vex enta fasting and prayers and God nor waste time to ansa ram.
Jobs come,scripts come,plenti mumu roles wit Mr Ibu come,money come,evritin double double,come.
Today now,God don givam a veri biutifu wife wey hin meet for church and dem don get three strong boys for dia union.
Nor be only dat one o.
He dey stay beta house now,he dey live beta life.
Afta he marry,he say di forma babe kon stil carry her two left leg comeback but by den,water don alreadi pass garri.
Fear God.
Friday, 5 August 2016
AMERICA GOFMENT DON WARN DIA PIPO MAKE DEM NOR VISIT BORNO,BAYELSA AND 18 ODA STATES FOR NAIJA BICOS DEM NOR DEY SAFE
America gofment don warn dia pipo make dem dey kiafu about di places wey dem go visit if dem dey enta Nigeria.
America name 20 states wey dem see as 'no go area'.
Dem say dis states dey dangerous so make dem shine dia eyes welwell.
Borno,Adamawa,Delta,Edo,Rivers,Gombe,Imo,Niger,Plateau,Kano,Bayelsa and Yobe.
Oda states wey dia name appia for dis list na,Sokoto,Zamfara,Jigawa,Bauchi,Kebbi,Kogi,Katsina and Edo.
America make una go sidon wia kontain una.
If una nor know di diferens bitwin peaceful states and jaguda states,make una talk.
Una kontri and naija wich one dey safe pass sef?
If nor be small tin Osama for bomb my broda join world trade senta for New York for 2001.
Thursday, 4 August 2016
'NOR BE PROBLEM IF MY WIFE NOR SABi COOK' ACCORDING TO BANKY W
Di man wey notice Wizkid talent Banky W,don reply Pastor Adeboye wey say if you woman nor sabi arrange koret wackis for kitchen,make you run for yor dear life.
Now miuzishan Banky W,don yarn say,nor be ploblem if hin wife nor sabi cook.
Wen tori babe,Toke Makinwa and her patna intaviu di bobo on top Ebony tv,he ask Banky weda he go fit marry geh wey nor sabi cook?
Banky say hin wife nor need to know how to cook bicos him dey enjoy to cook.
You agree wit Banky W or na Baba side you dey?
Wednesday, 3 August 2016
PASTOR ADEBOYE DON ADVICE BOBOS SAY,BIFOR MARRIAGE,IF YOUR WOMAN NOR SABi COOK CORRECT WACK,MAKE YOU GIVAM CHANCE
Baba don yarn o.
Di General Ovasiar of Di Redeemed Christian Church of God (RCCG),Pastor Enoch Adeboye,don yarn naija young bobos wey neva marry say,make dem shine dia eyes wella bifor dem put woman for house.
Baba say,if di woman nor sabi cook,if she nor fit pray for one hour,if di babe lazy,make you run for yor dear life.
He say make you take dis advice veri sirios bicos some pipo wey nor follow hin advice bifor,don dey comeback for prayers.
He also warn bobos make dem run from babes wey dey dance azonto,shakitibobo and Skelewu and babe wey dey club all night and oda nyama-nyama tins.
As he talk am, " nor marry girl wey dey worldly" bicos u go regretam.
Nor be only di boys Adeboye advice o,as he also advice gehs make dem nor marry man wey nor dey work to avoid storis dat touch.
Tuesday, 2 August 2016
SINGA SIMI,DON YARN SAY SHE START TO NOTICE BOYS VERi EARLY AND SHE GET HER FIRST BOYFREND WEN SHE BE 13 YEARS
Di truth and bitaleaf I nor know di one wey bita pass but dem say,di truth go set u free.
Nor be many gehs go tell u say dem know boys earli make u nor go group dem join bad gehs.
But Jamb Queshon singa,Simi,don yarn Tori pipo say she meet her first love wen she be 13 years old.
Simi say she dey SS1 wen she take fall in love wit dis bobo.
She say she just won turn 14 and di boy just start dia skool new.
Bifor u go say (Shuo) na pronoun nor be verb,dem don fall in love.
Akordin to Simi,di boy nor stay tay for dia school but dem later meet again.
Afta dat one,dem seprate and na so di mata take end.
But Simi u quik spoil sha.
MESSi BE LIKE DEAD WOOD FOR BED AKORDIN TO ARGENTINA MODEL,XOANA
Argentina model Xoana Gonzalez wey base for Spain,don finish soca star,Lionel Messi for ground as she say di bobo weak like dodo for bed.
He say although Messi dey young dat year but nor be small pikin.
Akordin to Xoana,she say na Messi sikioriti man naim link dem up.
She say,since Messi sabi hin work for football field welwell,he xpect di bobo to show am wicked wicked skills for bed but Messi fall her hand.
She yarn Peruvian Tv all dis one on top di program wey dem dey call 'Di value of di Truth'.
She say Messi be like dead bodi for bed as di bobo nor try at all.
Make we dey wait to hear from Messi as dis geh nor get joy.
If you dey folow up Messi,he don get two shidren alreadi wit hin frend and wife,Antonella Ruccuzzo.
We dey wait.
Monday, 1 August 2016
ADEKUNLE GOLD DON YARN SAY,HIM DEY FEAR TO FAIL BIFOR,BUT NOW,HIN BIGGEST FEAR NA MAKE HE NOR GO MISS HEAVEN
Ybnl singa,Adekunle Gold,don yarn Tori pipo say hin bigest fear bifor na failure but he kon find out say many tins worse pass hin fear.
Di bobo say wen you calm down and learn,you go do somtin beta .
So diafor,hin biggest fear now na make he nor go miss Heaven bicos hell fire nor be place to go.
Adekunle Gold wey also tell Tori pipo two days ago say,him stay dey kamkpe wit Ybnl and Olamide,just reliz hin new album and he call di album 'GOLD'.
Di bobo say wen you calm down and learn,you go do somtin beta .
So diafor,hin biggest fear now na make he nor go miss Heaven bicos hell fire nor be place to go.
Adekunle Gold wey also tell Tori pipo two days ago say,him stay dey kamkpe wit Ybnl and Olamide,just reliz hin new album and he call di album 'GOLD'.
Subscribe to:
Posts (Atom)

