MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday, 10 September 2014

FEDERAL GOVERNMENT SAY DEM GO BAN KPOMO FOR NIGERIA.



KPOMO OF LIFE
I no know weda you wake up from di right side of your bed dis morning but dis news go shock you and many kponmo lovers wen dem read am but sha o,no be evribodi e go shock.
Di tori now be say,Federa govment don conclude plan to soon ban kpomo from market bicos dem want make e for reach to take dey do leather shoe,leather bag and evritin wey dem fit use kpomo do.
Di minista of Agric and Rural development, Dr. Akinwunmi Adesina  naim yarn dis one on tuesday for di 3rd joint anniversary of Animal Science Association of Nigeria (ASAN) and Nigeria Institute of Animal Science(NIAS) wey shele for di University of Ibadan.
Dr. Akinwunmi yan say dem go bring law wey go stop di chopping and selling of kpomo so dat dem go fit make beta dollars from am.

Di minista wey be say na di Director, Animal Production and Husbandry for di Ministry, Dr. Ademola Raji naim representam,talk say,im tank (NIAS) for dia good work and how dem take dey also let farmers and leather compinis  know for radio and telivision say dem go make sirios money wen pipo stop to chop kpomo so dat dem go use am dey do beta shoe,correct bag and oda leda products.

Tuesday, 9 September 2014

BOKO HARAM DON SHOOT OBASANJO PIKIN FOR ADAMAWA STATE

LT COL ADEBOYE OBASANJO
Boko Haram for Mubi area of Adamawa state,don shoot former President Olusegun Obasanjo pikin, Lt Col Adeboye Obasanjo, wey be army engineer for di 3rd Division for Jos,Plateau State.
Dis one hapun wen Lietenant Colonel Adeboye Obasanjo lead oda sojas to go reclaim one town for Adamawa,Michika,wey Boko Haram don capture.
Tori wey dey rich us from di mouth of millitary pipo be say,dem don rusham go one hospita for Yola di capita of Adamawa state for tritment of di sirios bullet injuri for him leg wey im get from di hands of Boko Haram.
Dis gbeghe shele for Baza and Major Gen J.S. Zaruwa dey togeda for dis fight against Boko Haram wit Colonel Victor Ebhaleme, wey be di Brigade Commander of the 23rd Army brigade for Yola and Lieutenant Agwu.
Dem don nearly enter Michika bifor Boko Haram fighters open fire on dem.
Akordin to tori wey we also gada,di army loose one of dia armoured tank to Boko Haram and many of dem run comot for di area as dem see di heavy machine guns dem wey Boko Haram take dey fight dem and we also hia say na 24 sojas naim dem kill for dis gbege.

Monday, 8 September 2014

TWO POLICEMEN,FIREFIGHTER,3 BROTHERS,CUSTOM OFFICER, PLAY FOR GILBRATAR NATIONAL TEAM AS DEM CHOP 7-0 KONDO AGAINST POLAND



GIBRALTAR NATIONAL TEAM FROM A KONTRI OF 30,000 PIPO

Gilgratar di youngest UEFA memba kontri,loose 7-0 to Poland for dia own stadium for the Europe qualifier and na only 2 profeshona futbolas play for di match. Di rest na policemen,office worker,3 brodas,one custom officer,
Kyle Casciaro,one of di 3 brodas na shipping agent,him broda,Ryan Casciaro,na policeman and di last broda,Lee Casciaro,na policeman too.
GIBRALTAR STARTING XI OF 2 POLICEMEN,FIREFIGHTER AND DI REST

Jordan Perez na firefighter and naim be dia goalkeeper,Rafael Bado na store keeper.
Di two playas wey dey play as profeshona futbola na Scott Wiseman wey dey play for Preston for England and Liam Walker wey dey play for Bnei Yehuda for inside England.
Gibraltar na small kontri and na only 30,000 pipo dey inside.

Saturday, 6 September 2014

PRESIDENT JONATHAN MUST ENTA PRISON FOR 2015 IF...SSCEC

PRESIDENT EBELE JONATHAN
Di South-South Chiefs and Elders Council, SSCEC International,don yarn say President Ebele Jonathan go enta heavy gbege for dia hand and he go sleep for prison if he no re-contest for next year elections.
Dis group talk dis one for Abuja for di choosement of Jonathan as di pesin wey dem go suport for who go be president for 2015 elections.
For di join bodi for Abuja,dem also carry di Transformation Excellence award giv di Federal Ministry of Information and other ministry wey dey do dia work well.
About di 2015 elections,di Executive Chairman of di SSCEC, Ama-Opu Senibo of Opobo Kingdom, Chief Reuben Jaja, yarn say na nothing but Jonathan for 2015 bicos he don make pipo proud for di way wey he don rule Naija.
He say Jonathan don try welwel for di area of education, agriculture, transport, women affairs, entertainment and oda dificult areas.

Wednesday, 3 September 2014

BIG BROTHER AFRICA HOUSE DON BURN REACH GROUND


Just five days to the day wey dem supose launch Big Broda Africa Show,fire don burn di house rich ground and dis one kon force di organizas of di show,M-net and Endemol South Africa to postpone nam.
As we dey yarn now now,investigashon of wetin hapun don alreadi stat bicos nobody don know wetin cause di fire.
If you rememba,diu to changes to get South Africa visa nowadays,Endemol no select pesin wey supose represent Ghana from dat kontri as dem pick Ghanian wey dey stay Sauti so dat e go waka enta di house easily from there.
Dis year also dem no pick anybodi from Rwanda and Sierra Leone.
Dis fire don affect di hole show as di oganizas dey look for anoda place make dem for fit quick stat di show but bicos of di technical issues,plenti cameras and editing tings wey dem go need,to see di place wey dem go take replace am no go easy.
Big broda wey be di biggest true life stori show for inside Africa,supose enta sizin 9 from septemba 7th,bifor fire kon change di plans


Tuesday, 2 September 2014

HOW ONE BOBO TAKE KILL HIM PAPA BICOS OF ONE STICK OF CIGERETTE


Na only pesin wey im brain don turn upside down go kill anoda pesin bicos of cigar.
Dis tori get as e be for ear but no be joke o,as one 25 years old bobo,Best Momodu,don kill im papa bicos of one stick of cigar for Estako West for inside Edo state wia di bobo come from.
Di guy make dis confeshon yestaday wen di Edo State Police Command showcase ova 63 criminals to di world for diferen diferen offence.
Inside dis 63 pipo,some na arm robas,some na killas,some na pipo wey rape small small shidren,and Best Momodu imsef wey kill im papa bicos of ordinary cigar.
Him say,he go wia him papa kip cigar and e kon dodge one take go smoke.
Afta him papa find out,naim he kon dey shout foram like dog say"u dey mad!why u go take my cigar for wia I kipam?me and you na age?I buy di cigar bicos of you or I kipam for your head?"
Him say im kon para bicos him papa dey quarel witam bicos of ordinary cigar,naim vex go take knife by mistake and stab im papa.
Wen di villagers see say im don shook im papa,naim dem catcham and dragam go stayshon go giv police pipo.
Best Momodu say im neva see di dead bodi sha o,but hin don hia say him popsie don die from cell.

OSAZE ODEMWINGIE NO GO PLAY SOCCER TILL NEXT YEAR BICOS OF INJURY.

INJURED OSAZE

Naija futbol fans go dey veriveri disapointed say Super Eagles playa,Osaze Odemwingie no go fit play ball dis year again and even some part of next year bicos of di sirios injury wey ein get wen e dey play for him club,Stoke city against Manchester City on Saturday aftanoon.
Osaze dey bench and Stoke coach Mark Hughes putam for di match for di biginnin of di second half.
Afta di match di coach say di injuri no too sirios but tori wey we gada now be say,naim cruciate ligaments naim he damage and dat one dey take time to heal.
Altho dem win di match sha by one kondo and na Senegal Mamodou diouf naim skor di goal,but Osaze injuri na heavy blow to Stoke city and espeshialy Super Eagles wey dey stat dia qualifying matches for nations cup wey go shele for Morocco  for 2015.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...