Wondas as dem talk am no go eva end as dis kain ponishment wey dis tisha giv to dis skul shidren na yeye nonsense.
Di tisha wey u dey see for dis pishor so,tell dis pikin dem say make dem pack sand for ground take brosh dia teeth as ponishment.
Na Badagry for inside Lagos naim e for appun but as at wen we write dis tori,we neva know di name of di tisha and di name of di skul.
I stil dey wonda wich kain ofence dis shidren comit wey make her trit dem like so.
Many nonsense wey worse pass dis one dey appun evriday for our skools but na di ones wey we see naim we dey yarn about.
I hope say gofment go fish dis woman out and give her beta ponishment so dat odas go learn fromam.
Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Thursday, 5 November 2015
Wednesday, 4 November 2015
O BOY!U DON HEAR SAY RIHANNA DEY PLAY ENTA CALABAR?
As I dey see di mata,e be like say krismas go toff for Calabar dis decemba as plenti fans go play enta town just to see bad girl Riri.
Chris Brown forma babe Rihanna naim go be di main star wey go sing for dis year Calabar carnival.
Akordin to di oganizas,Rihanna go play for di afta party wey go appun for Decemba 27 for di U.J Esuene stadium.
Evribodi know say wia she come from Barbados,na dia caniva for use hand touch ground.
Barbados,Trinidad na two kontri wia dem fit die for carniva mata.
Dem no dey use caniva play for dia as Rihanna even attend dis year Barbados festival for di Foreday Morning Jump Up Party.
Oda celibritis wey go add color join di Calabar festiva na Sean Paul,2face,Timi Dakolo,Flavour,Mavin group,Mc Galaxy,Banky W,Duncan Mighty,Burna Boy and Raskimono.
Oda stars wey go show dia talent for stage dat day na,D'banj,Mafikizolo,PSquare,Iyanya,Kcee,Omawunmi,Dare Art Alade,Timaya,Seyi Shay and plenti odas.
Comedians like Bovi,Akpororo,Last Prophet and IK and Uti as anounsas,go show dia jersey numba dat day.
Intanationa gospel miuzishan Don Moen sef and our own Sinach go full ground berekete for di Calabar Festiva.

Tuesday, 3 November 2015
SURPRISE! SURPRISE! AS ADAM AND EVE DON SHOW FACE FOR LEKKI,LAGOS
Seyi Shay don start anoda one as she don snap plenti foto wey she call "corruption of eve" and na Remi Adetiba naim direct di fotografi.
Na Lekki Conservative Centre,Lagos naim be di garden of Eden dis time around and Seyi Shay naim act as Eve.
Many pipo biliv say if nor be Adam and Eve,we for dey enjoy anyhow today.
Mosquitos for no dey,sardine and geisha for be free,evribodi go get dia own bank for dia backyard,joliment go dey yanfuyanfu.
Bois don try to forget evri evri wey appun dat time and kon kontiniu to take life jejeli bifor Seyi Shay kon reliz dis fotos to take remind pipo of wetin Adam and Eve cause.
Well God dey.
Dem even showcase dis foto dem for di 2015 Lagos Photo Festival.
See more fotos for bottom hia.

Monday, 2 November 2015
SEE FUEL PALAVA AS WOMAN WEY CARRY PIKIN FOR BACK GO FETCH FUEL FROM TANKER WEY FALL(FOTOS)
Dis one na case of yanga dey sleep,trouble won wake am.
E be like say pipo don foget wetin appun for Jesse for Delta state some years ago wen pipo wey go fetch fuel for bust pipeline die like fowl full ground.
For dis foto,wetin u go talk about dis woman wey carry pikin for back and join go pack fuel from tanker wey fall for Mowe Ibafo last weekend?
Any small fire for dat place,evribodi don quench be dat.We know say na wetin poverty dey cause all dis nonsense but if she won die,why not die alone and live dat inosent pikin for haus?
Dat pikin can be future comishona,dat pikin can be future senator,dat pikin can be future president,dat pikin fit stil get many tankers for future.
If die hungry anybodi,make e no draw anoda pesin folow bodi.
Die yor die alone.
Sunday, 1 November 2015
YOU GO FEAR FEAR IF U SEE Di WAY WEY DEM TAKE CATCH Di BIGGEST CROCODILE FOR Di WORLD
Like say di popular late crocodile hunter from Australia, Mr Steve Irwin, still dey alive, trust am, he for don catch di nearest flight go Panama go play wit dis giant crocodile wey pipo don alreadi dey call di biggest crocodile ever.
Bifor dis one show face for dis kontri wey dem dey call Panama, di biggelest crocodile for di world dey measure 18 feet long and e dey weigh 2,200 pounds.
Na chicken,fish and pork meat di owner take dey feedam.
Dem even name am Cassius and na 111 years we hear say di crocodile live.
Wit dis new crocodile wey dem catch for Panama canal so, e be like say Cassius tenure as di largest crocodile don expire.
As I dey write dis tori, dem say di pipo wey catcham for di canal don rush go buy tape for market to measure ram.
I go bring una di figures of di measurement wen dem measure ram finish.

| George Craig dey feed forma biggest crocodile for di world |
Wit dis new crocodile wey dem catch for Panama canal so, e be like say Cassius tenure as di largest crocodile don expire.
As I dey write dis tori, dem say di pipo wey catcham for di canal don rush go buy tape for market to measure ram.
I go bring una di figures of di measurement wen dem measure ram finish.
VIRGIN BABE(?)JODIE,DON MARRY HER ACTOR BOBO
I nor know weda she dey lie dat time or not but if u like biliv,if u like u nor biliv di tori be say,di kuchi kuchi singa,Jodie,bin tell us last year say she be virgin and di rizin be say she nor want anyhow man wey go use am dey play ten ten.
But now,Baba God don spread joy enta her side as she don do her tradishona wedding wit her bobo,David Nnaji for Warri yestaday.
Now Jodie can do anytin she like wit her love life as far she don chuz him bobo.
I hope say pipo go fit mind dia bizness now.
No more queshon of u stil be virgin or not.
But make I ask one queshon.
Her belle big o,na wetin she chop?
If u rememba,Jodie say e nor good at all make man and woman dey do touching bodi if dem neva marry.
But from one of dis pishor wey I dey see so,e be like say she don chop belleful.
Abi she nor kip to her advice?
Anyway sha.
Her hosband David Nnaji na actor and also Jodie manager bifor dem marry.
Congratulabia to dem plenti.

VIRGIN BABE,JODIE,DON MARRY HER ACTOR BOBO
If u like u biliv if u like u nor biliv di tori be say,di kuchi kuchi singa,Jodie,bin tell us last year say she be virgin and di rizin be say she nor want anyhow man wey go use am dey play ten ten.
But now,Baba God don spread joy enta her side as she don do her tradishona wedding wit her bobo,David Nnaji for Warri yestaday.
Now Jodie can do anytin she like wit her love life as far she don chuz him bobo.
I hope say pipo go fit mind dia bizness now.
No more queshon of u stil be virgin or not.
David Nnaji na actor and also Jodie manager bifor dem marry.

Subscribe to:
Posts (Atom)