MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday, 3 December 2015

WONDAMENT!!! SEE Di 11 YEARS OLD BOY WEY BOKO HARAM SEND TO GO COMMIT SUICIDE BOMBING

To send 11 years old boy make he tie bomb for bodi so dat he go kill imsef and oda pipo,all in di name of fighting for our right,na veri wicked tin.
Even sef,make somebodi take di life of anoda human being,na veri veri bad tin.
Imagine as Boko Haram send 11 year old Usman Modu Tella to go comit suicide bombing.
Wot a wicked world!
Tank God for di vigilante wey dey provide sikioriti for di camp of pipo wey nor get haus to stay again for Borno state afta Boko Haram attack dem.
Na di vigilante pipo kon catch di boy wey also confess anoda boy wit di same mission for inside di camp.
Akordin to di tori wey di acting direktor Army public relations orfisa,Colonel Sani Kukasheka Usman give tori pipo,he say di smallie dey nomba 82 for di list of di 100 most wanted terrorist.
Di boy na one of di four shidren wey Boko Haram don train for suicide bombing as di oda three don alreadi carry out dia mission.
God save yor shidren.

Wednesday, 2 December 2015

O BOY,SEE AS FALZ DI BAHD GUY TAKE PUT ONE BABE FOR TROUBLE FOR INSTAGRAM

To wish pesin happy betday again na sin?
Shuo!naija pipo make una calm down o.
Imagine, Falz wish one babe hapi betday for Instagram and fans kon dey insult di babe lips.
Weda na di geh krate hersef I nor kon know o.
Some say her lips too big,some say maybe na philLIPins she come from.
Too many yeye talk evriwia.

CYNTHIA MORGAN WIA YOU DEY?E BE LIKE SAY DIS UK BABE RESEMBLE YOU O!

Indiana Ifil,di UK base singa and song writa,rezembo naija dancehall singa,Cynthia Morgan no be small.
If u nor know,yor eyes fit disiv u on who you dey see.
Di only tin wey I no fit talk now,na who mad pass among dem two.
We don alreadi know say Cynthia Morgan no send anybodi but weda Indiana Ifil blood dey hot like Cynthia own naim I stil dey find out.
See more of dia pishor for bottom hia:


HALLELUYAH!!! SOUTH AFRICA DON OVATAKE NAIJA FOR CORRUPTION...OYA READ AM

Nigeria dey carry first for many yeye tins but make i nor menshon dem.
E get one tin wey naija for nor dey carry last but nomba one evritime and dat tin na koropshon.
But bifor South Africa fit ovatake us for koropshon for Africa akordin to Transparency International,naim be say beta dey come.
I be no won biliv but bicos say Transparency International na joinbodi wey dem know for di world to dey check many tins wey nor dey rite,naim make i biliv.
Bifor dem go rank kontris for dis kain mata,dem go fest do di survey and afta dem do am,na South Africa naim win di koropshon cup for Africa.
But sha o,Nigeria and Ghana akordin to Transparency International,na two kontris wey still koropt welwell as na small gap naim South Africa dey give dem.
Anyhow u see am sha,for us not to dey nomba one,show say hope dey.
Bicos bifor,we dey carry fest for di hole world for koropshon not to talk of Africa.

YAGA!!! WIZKID DON DEY MATURE O!SEE WETIN HE REPLY ONE FAN WEY CALL AM 'MUMU' FOR TWITA

If na bifor,dis bobo wey he name na @vjkunzee for twita,for don resiv one beta curse from Wizkid afta he call Wizzy mumu on top say,for di #Longthroat pepsi advert,Wizzy use Ferari motto of one million dollars,take exchange ordinari bottle of pepsi wey dem dey sell N100.
Infact di wholesale price for pepsi na like N80.


Altho e be like say na joke di bobo dey joke but if na Wizkid of dose days,he no go care weda na joke.
He for samaram one wicked reply and di bobo sef go filam.
He show say Wizkid don dey escape comot from kid dey enta man mode as he don dey control him tempa.
Nice one Wizzy,kip it up.
Na so e soppose be.

Tuesday, 1 December 2015

O BOY! DIS GENEVIEVE DAUGHTA SET DIE,CHAi!

Nor be small tin o!
Chimebuka Nnaji aka "Theo",di name wey her close friends dey call her don big finish.
She be nollywood actress,Genevieve Nnaji dota.
Thank God say Genevieve nor tempa wit di pregnancy wen she dey pregnant if not dis fine angel nobodi for siam.
Mama and pikin
Genevieve carry belle wen she dey veri young and she born di pikin.
Today dat pikin,Chimebuka,don large welwell and her mama dey veri proud say her pikin don pass 20 years alreadi.
Di babe set,di babe enta,her figures na die,in short Genevieve u try.
Dem rezembo finish nor be small.
If u siam u don see Genevieve be dat.

I DEY SELL POPCORN N800 FOR SILVERBIRD BUT MY WORKERS SALARY HIGH PASS GOVMENT WORKERS OWN

Senator Ben Bruce,di owna of silverbird cinema,don reply one bobo for twita wey dey kriti-size am of selling ordinari popcorn for siverbird for N800 and yet naim dey sharp mouth say our gofment bad.
Di guy dey try let us know say,Ben Bruce no be beta pesin too as far as he dey sell popcorn N800 wey dem dey sell N100 for outside.
Ben Bruce wey dey represent Bayelsa east for senate kon reply di guy on top twita say,
Dat naim cup of tea bicos even tho he dey sell popcorn N800,him dey proud as he dey pay ova 1000 workas more dan N18,000 wey be di minimum wage for naija.


He say him dey proud wit imsef bicos our govnors dey cry say N18,000 too much to dey pay workas.
Just last week,Ben Bruce blast our govnors afta dem yarn say N18K a month too much for dem to dey pay workers.
Read wetin Ben Bruce tell di govnors for hia...http://ogakpatakpata.blogspot.nl/2015/11/devils-our-governors-too-wickedeven-dia.html?m=1

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...