Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Wednesday, 3 February 2016
SEE DI STRONG FERRARI MACHINE WEY WANDE COAL POSE AND TAKE FOTO WITH
Wande Coal just dey waka round dey flex imsef.
Well,aftaraw naim get di raba.
If u nor use am for yorsef,who you won use am for?
Di bobo play enta California and he pose near one Ferrari ride.
E be like say enviromenta sanitation dey California dat day.
Dem nor dey open dia shop?
Nobodi dey waka pass sef.
Make I shut up maybe Wande Coal don buy di street.
Anytin kan appun.
Tuesday, 2 February 2016
OLAMIDE BADOO DON HOOK UP WITH BUHARI DURING DI CELEBRATION OF OGUN STATE AT 40
Nor be evribodi street miuzik don pay o,but if dem get anybodi wey e don pay,dat pesin na Olamide.
Di Miuzik wey di bobo dey play don carry am dey enta many places for di world.
Nor be only dat one be di mata as badoo don play for many big pipo and hang out wit many big names.
For wikend,Olamide hang out wit Ooni of Ife.
Yestaday,na Naija Presido,Buhari and di govnor of Ogun state,Ibikunle Amosu naim he meet one on one as he go play show for dem during di 40years celibrashon since dem krate Ogun state.
Wen mata pure for pesin life,e nor dey hard to know.

KIM KARDASHIAN AND AND AMBER ROSE DON SETTLE KANYE WEST AND WIZ KHALIFA THRU SELFIE
Nor be dis two hot oyoyo babes cause Kanye West and Wiz Khalifa quarel for twita but di two of dem don finali setle di two crazemen fight.
Kanye West say di title of een new album na 'Waves' but Wiz Khalifa say dat na wrong move as waves na Max B name.
Nor be small quarel as Kanye vex insult Khalifa welwell and even insult een forma wife Amber Rose and dia two years old pikin.
Amber Rose kpakpa,na Kanye West forma babe bifor he kon marry Kim Kardashian.
Now di two babes don take one strong selfie and postam just to setle di gbege.
Even Kanye West yarn afta di selfie say he don setle wit Khalifa but Khalifa stil dey form bado as he neva yarn anytin about di setlement.
I nor blame dem.
If dem get moskito problem,Nepa problem like us for hia,dem nor go quarel ova nonsense.

CHECK OUT DI ASSORTED MEAT FOR DIS CALABAR BOYS SHOPRITE FOR MY AREA
Some pipo say dog meat swit pass honey why some of my Calabar frend like Uwem,say afta Heaven,na dog meat.
I neva eatam once but anytin kan appun.
I nor dey soprise say plenti dog meat restaurant,shops and bar don dey open for evriwia.
Di way wey dem take pakage dis dog meat for dis pishor,mehn I fit enta town earli momo tomorow.
Abeg try eat dog meat and yarn me if di taste dey wondaful make I rosh go fil up my friza.

PAUL OKOYE OF PSQUARE DON REPLY BLACKFACE SAY NOR BE HIM BE DI FIRST PESIN TO INSULT DEM SAY DEM BE COPY COPY MIUZISHANS
Afta all di beef wey don dey appun bitwin our celibritis dis year, I hope say di tin go calm down small.
Rememba say Blackface don accuse 2face and Wizkid of tiffing een songs and Dammy Krane sef accuse Wizkid of tiffing een song too.
One pesin wey nor hapi for all dis tins na Paul of Psquare as he say na chip populariti pipo like Blackface and Dammy Krane dey look for.
Blackface nor waste time to yab Paul as he yarnam say na dem be king of copy copy for naija.
Inshot he say na dem be di Milli Vanilli of Naija.
Paul don reply di forma plantation bois memba say nor be today pipo don dey call dem copy copy and he say in di first place,he nor menshon anybodi name bifor Blackface kon dey call he name.
So if Blackface call dem copy copy nor be new tin.
Paul yarn all dis one wen he follow Hip tv do small amebor.
He say nor be beta tin for anybodi to dey giv dem bad name bikos dem dey work hard for demsef and e nor see any rizin why anybodi go dey yarn labalaba.

Lol..SEE WETIN BOVI USE DEMUREN AND TOOLZ FOTO TAKE DO AFTA DIA WEDDING
Dis Bovi guy na one of di few crase wey neva stil get cure for naija comedy.
Di wedding of di year for now,radio babe, Toolz and pilot, Demuren,appun ova di wikend and some few pipo nor get chance play enta di groove as dem go run dia parole wey dem don alreadi arrange.
One of di few pipo wey nor show face for di ground na Bovi but he stil get time to read meaning to di pishor wey Toolz and Tunde Demuren snap.
He trow di joke on top di pishor for Instagram and di bobo try to imagine wetin dey run tru many men mind during bride price wahala.
Nor be small tin.

Monday, 1 February 2016
KING WIFE DON ENTA ONE CHANCE FOR UDUMUJE UGBOKO FOR DELTA STATE AS DEM DON DRIVE HER FROM PALACE BICOS OF KUKERE WAKA
Oba nor dey go transfa as dem talk am but Queen Okwukwe Nwoko,di wife of Obi Agbogidi Nwoko 111 of Idumuje Ugboko Kingdom,Aniocha north,Delta state,don get transfa to comot from di palace bicos of kukure waka.
Akordin to di mata wey dey ground,dem say she dey waka pionpionpion go find man.
Dem even akiuz her say,nor be di Obi givam belle of her three year old dota.
Well,I hope say nor be bikos di Obi na 90 years naim make her dey shook leg for outside?
Well,I just dey ask sha.
Di main pesin wey dey giv di Queen headache na,di Obi son,Prince Nonso Nwoko bikos he nor won see di woman for di palace.
Nor be only di kukure waka be di problem o,dem say dem also catch her dey watch blue film for inside palace.
Wey dem gada all dis tins togeda, naim dem drive am from Obi Agbogidi Nwoko palace.

Subscribe to:
Posts (Atom)