MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday, 7 February 2016

ZARA,DI BABE WEY GET BELLE AND BORN FOR BOKO HARAM MEMBA DON YARN SAY SHE DEY MISS DI BOKO HARAM GUY LOVE BADLY

Zara John,di 16 year old geh wey Boko Haram kidnap dat year,don yarn say she dey miss one of dia memba wey giam belle.
Afta naija army reskiu her,her family membas kon dey konfiuz as some say make she do abortion bikos dem nor want pikin wey go be bastard.
Di pipo wey say make she livam naim plenti pass.
So she kon born di pikin wey dey 7months old now.

I nor know why she nor tell di sojas wey reskiu her say make dem live her wit her Boko Haram frend.
If dis kind geh fit see her pikin papa again,I hope say,if dem send her go suicide bombing,she nor go go.
Na so e take dey start.
Pesin wey love terorist go readi to go any mesage wey di terorist go sendam.

Saturday, 6 February 2016

YORUBA TRADITION DON MAKE 78 YEARS OLD OBASANJO POSTRATE FOR 41 YEARS OLD OONI OF IFE

If dem get any tribe wey like to dey postrate for elders for naija,dat tribe na Yoruba.
Any small tin Yoruba pipo don postrate flat for elda as mark of respect and dat na veri gud tin.
Yestaday for Ibadan,forma civilian and khaki presido,Olushegun Obasanjo visit di new Ooni of Ife,Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi Ojaja II and he slip for ground flat to grit di 41 years old Oba.
Obasanjo imsef wey be 78 years old respect di yoruba tradition even tho many pipo see am as jaguda oga.
Obasanjo carry waka go visit di Oba to gritam for all di effort wey een don bring to take unite di yoruba nation.
See more of di pichors for bottom hia..





Thursday, 4 February 2016

FEDERA GOVMENT DON YARN SAY,HUNGER GO KILL EVRIBODI FOR NAIJA BY 2050 IF WE NOR TAKE FARMING SIRIOS

AUDU OGBEH
Oga for food and farm mata,Chief Audu Ogbeh wey be di Minista of Agrikochor,don yarn say,34years from now,if we nor use our church mind take farming sirios,hunga go take our eye see pepper.
Di minista say 34years from now wey be 2050,naija population go don rish 509million pipo and if we kontiniu like dis,we go hiaram.
He say food like kasava,yam,corn,vegetables,rice,beans,okro,onions,garri,kpofkpof,malu and plenti oda food,get boku bikos of di population wey go ova boku by 2050.
Di forma PDP nationa chaman,Audu Ogbeh, yarn all dis one wen he dey difend di 2016 budget.
He say naija get di pawa to do wondas wit farming bikos evritin dey wit us.
He also yarn say him don write leta to state gofment make dem take dis farming bizness sirios,if not,we go kash winch.

BUHARI 1 CORRUPTION 0: TRANSPARENCY INTANATIONAL DON REMOVE NIGERIA NAME FROM COUNTRIES WEY CORRUPT


Di national coordinator, Muhammad Labbo and the secretary, Cassidy Madueke, yesterday for Abuja,Buhari Media Support Group (BMSG),don clear us say,Transparency International(T.I) don remove naija name comot for kontris wey koropshon hold for shokoto.
BSMG say for T.I latest names of kontris wey koropshon don enta dia blood,Nigeria name dey miss for inside like chibok girls.
Di group say dis one show say Buhari fight against pipo wey don sock naija dry,dey bring beta results.
We don hear.
We dey wait.

EWOO! OSHIOMOLE BIUTIFU WIFE,LARA DON READY TO DIVORCE DI GOVNOR AND LIVE DIA MARRIAGE?

Tori wey dey fly pass my backyard now now be say di biutifu wife, Lara of Edo state Govnor Adams Oshiomole don readi to remove from di mariage.
Akordin to di tori,she say Oshiomole dey put hand for otumorkpor tins and na heavi jazzman.
She say she don tire for di juju lifestyle wey di govnor dey live.
Lara wey come from dat small African kontri,Cape Verde,even yarn say na Oshiomole kill him late wife Clara Oshiomole wey die for Decemba 7,2010 afta she battle wit breast cancer.
We dey wait to hear from Oshiomole camp weda na just rumor or truth dey di tori.

BREAD SCARCITY DON HIT KANO BICOS BAKERS DON STRIKE AS TEA AND BREAD SELLERS DEY PARA


About 8,000 bakers don klose dia shops for Kano state as dem don start strike bikos of high cost of flour for di state.
Akordin to di P.r.o of mastas bakers association for di state,Mallam Kabiru Hassan,he say dem nor fit bieram again as dem don put money on top flour and oda tins wey dem take dey produce bread.
Dis scarcity don turn Kano upside down as na one kain wack 'Gurasa', pipo for area dey blast now.
Even malams wey dey sell tea,di tin dey touch dem as dem dey konplain badli.
Mallam Sanusi Hamisu wey dey sell bread and tea for di popular Ahmadu Bello way,say na die dem dey and he biliv say na plan work to take sofa di comon man.

Wednesday, 3 February 2016

ARREST GOODLUCK JONATHAN NOW! ONE MAN DON WEAR BANNER FOR NECK AND HE WANT MAKE DEM ARREST OGA JONA

Evribodi wit dia tinking and dis man right now tinking cap dey showam only one ting;Arrest Goodluck Jonathan!
Di man stand outside dis  National Assembly dey do one man pol protest.
Moskito dey use some of di men wey work wit Uncle Jona dey do shege for prison now sake of say dem use money wey dem sopose take buy wipons take play pasona kalokalo.
Dem die $2.1billion dollars and shiaram among demsef.
Di man wey Jona put di money unda him care,Sambo Dasuki,dey prison and he don sing song wey EFCC dey enjoy.
As u dey read dis tori,u go dey pray make he nor call yor name among pipo wey chop for di money.
Some pipo don dey say boys kant use money wey oga take sendem mesage witout say oga nor giv dem orda and na dis one naim make dis man wey dey protest for National Assembly want make dem arrest Oga Jona make he kon yarn wetin he know about di money wey grow wings all of a sudden.
Well make we dey wosh weda dem go take dis guy sirios or e dey on he own.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...