MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday, 11 October 2016

CHRISTMAS RICE? Di MINISTA FOR AGRIC AND FOOD MATA,CHIEF AUDU OGBEH,DON YARN SAY,Di PRICE OF RICE GO COME DOWN FOR NOVEMBER WEY BE Di NEXT HARVEST PiRiOD


Nor be me talk am o!
Na di minista of agric and rural development,Chief Audu Ogbeh,naim talk say,di price of rice wey don cost pass gold for naija since dem ban importation,go drop dis novemba.
Akordin to Ogbeh,he say na novemba be di piriod wey harvest fall put so diafor Christmas rice go berekete for our pot.
I hope say nor be politishans ogogoro dey at work?
Nor be today we don know say,di real promise and fail pipo,na politishans.
If u rememba last month,di minista of state for agriculture,Senator Heineken Lokpobiri say rice fit sell for N40,000 if we nor do somtin about am.
We dey wait.

Monday, 10 October 2016

KCEE LIMPOPO DON TALK SAY,NA BEER PARLOUR HIM FOR PICK IYANYA AND HARRYSONG BIFOR DEM BICOM WHO DEM BE TODAY


Five star miuzik bobo,Kcee,don yarn tori pipo say na beer parlour e for meet Iyanya and Harrysong bifor dia miuzik karia turn around for good.
He say hin meet Iyanya for one bar for Calabar dey sing and from dia,he fly am enta Lagos.
Him buy Iyanya di first Eva aeroplane ticket to Lagos.
Afta dat one,he also regista di bobo for Mtn Project Fame konpetishon wey Iyanya later win.
Since he win project fame,he neva look back again.
For Harrysong,Kcee say na for Ojez bar naim he for mitam.
As for di new bobo wey just sign for Five star miuzik,Xbusta,di limpopo singa say na anoda bar for Owerri he for siam.
Na wa o,stori dey.
Kcee and di bar boys,my Nollywood film go start soon.
All rights reserved.

Sunday, 9 October 2016

SUPASTAR AMERICA MUSICIAN CHRIS BROWN,DON USE ONE BABE PHONE NACK GROUND SKATA FOR KENYA,SAKE OF SAY SHE WON TAKE FOTO WITAM


Dis Chris Brown hot tempa go putam for big wahala one day.
Odnari pishor wey one of hin fan won folow am snap,naim di bobo destroy di babe iPhone for Kenya wen he go play show for dia.
Di babe wey di tin appun to Brenda Chepkoech,even folow Wizkid wey pafom for di show,take one quick selfie foto.
Now Kenya pipo don dey shout say make gofment sendam back to him kontri.
Some months ago,dis kain tin also appun as Congo Zaire miuzishan Koffi Olumide,kick one of hin dansa for Jomo Kenyatta intanashona airport for Nairobi and di Kenya gofment nor waste time as dem arrestam and sendam back to him kontri.
Dis yeyebritis neva jam pesin wey hin head dey hot.
If Chris Brown destroy one of my frend Okorowanta phone,he go undastand di true meaning of madness.
I know wetin Okorowanta do one soja wey go flogam by mistake not to talk of bloody civilian.
Any star wey nor won wise and respect him fans,go jam pepper one day,one day.
Nuff respet to any selebriti for di world wey know how to trit and value hin fans.


CELEBRATION AS FEDERA GOFMENT PiKiN,CUSTOMS, DON FINALLY AGREE TO OPEN OUR BORDERS AGAIN SO DAT E GO DEY EASY FOR TRADERS TO DEY CARRY RICE ENTA NIGERIA


God don touch Federa Gofment mind as dem don agree to open our borders again for rice traders to dey carry dia market enta Nigeria.
Na one of Federa Gofment shidren,di Nigeria Customs,na dem yarn dis one.
Di Comptroller-General of Customs,Colnel Hameed Ali (rtd),naim yarn dis one.
Akordin to di tori wey di publik relations officer of customs for di kontri,Mr Wale Adeniyi yarn di News Agency of Nigeria,NAN,he say,Oga Hameed,don giv order wit imidiate effect make Customs remove rice name from di goods wey dem ban to enta naija.
Although sha,small condition dey as di rice traders go dey pay for Customs duties.
Wit dis one krismas go sweet wella for many families.

Saturday, 8 October 2016

MAGICIAN! WATCH JAY JAY OKOCHA AS A MIUZISHAN (VIDEO)


                                       
Hmm,I nor kon understand why Jay Jay dey fear to open hin mouth sing for dis vidio.
Dem forsam sing dis song sha,dat year for Germany afta he show dem say,him gada skills full legs.
Studio owna and singa,Martin Meinschaefer use hin kontat wit Okocha club Entraicht Frankfurt for 1993 take use am sing di song wey dem call, 'I I am am Jay Jay'.
Rumors wey I hear dat time be say,di song enta one German chart and e do well for yonda.

Oya watch di old school vidio for bottom hia....


TAILOR AND MUSICIAN,SEXY STEEL,SAY, NA BICOS HIM NA FINE BOY NAIM MAKE PIPO DEY TALK SAY,NA SUGAR MUMMY DEY GIVAM POCKET MONEY AND FEED AM,BUT HIM NOR CARE


Tailor and forma  memba of Hi-Profile' miuzik group, Sexy Steel,don dey para for pipo wey nor won alaram drink water put cup for ground.
He say just bicos say him na fine boy,pipo just dey talk say,na sugar mummy dey fidam and also givam pocket money.
Steel say anytin dem like make dem yarn,e nor konsign am.
All he know be say him na beta tailor and he also get wondafu miuzik

He say dis two jobs dey put plenti food for him table.

Friday, 7 October 2016

DAVIDO SAY HE DON DEY CALL HIM PiKiN MAMA SOPHIA 'BIG HEAD' SINCE,EVEN BIFOR DEM START DiA QUARREL


Davido Davido,
You worry sha.
If i tell u say Davido save hin baby mama name as 'Big Head', you go biliv?
My pipo,na wetin di bobo take save di babe name be dat for phone.
Akordin to di bobo,he say e don tay wey he dey call Sophie big head,even bifor dem start dia quarel.
David say na di nickname wey he dey call di babe be dat for years.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...