MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday, 23 January 2016

MR IBU DON TELL NOLLYWOOD PIPO SAY,ANYBODI WEY CHOP FOR INSIDE DI PLENTI MONEY WEY GOODLUCK JONATHAN GIVE DEM,GO DIE

Mr Ibu
Nor be news again say many pipo benefit from di forma gofment of Goodluck Ebele Jonathan.
Di entatayment industri benefit welwell like agric fowl wey dem give fatalizer chop.
Many celibritis bank account fat wella bifor last year election espeshali di account of nollywood stars.
Mr Ibu don dey swear for pipo wey Uncle Jona put di money for dia hand wey nor gree investam inside di nollywood industri espeshali dat dia join bodi asosiation,Actors Guild Of Nigeria (AGN).
Mr Ibu say all of dem go kpeme bicos dem nor know how many souls don die bicos of di money wey dem cramp for dia pasona gain.
Nor be lie Mr Ibu yarn sha bicos e get some nollywood actors wey don die bicos di joinbodi lidas nor gree put money for ground to take asist dis pipo during di piroid wey dem dey sick.
Mr Ibu,if anybodi die by mistake for dis una industri,Nigeria police fit go arrest you o.
Make anybodi nor die o,make dem just vomit di money.

Friday, 22 January 2016

SHUU! ANODA BEEF AGAIN! LOLO 1 OF WAZOBIA FM DON YARN COMEDIAN PRINCESS MAKE SHE STOP TO FOOL HERSEF FOR STAGE

Princess and Lolo

LOLO
2016 don dey turn di year of beef and kpomo for naija celibritis.
Dats y dem say who eva dey top make he lead well so dat di rest pipo go see beta tin wey dem go copy.
Now see di kain yeye seed wey Olamide and Don Jazzy fight don make dey jaminate.
Evri week,one beef must come out and di latest wey I don dey notice na bitwin Lolo 1 of Wazobia fm and xpirience comedian,Princess.
Lolo don say make Princess dey respect hersef dey comot for stage wen nobodi dey laff to her jokes.
She yarn dis one on top Instagram.
Lolo say make Princess stop to embarrass dem.
She say wetin Princess dey do nowadays nor be comedy again bicos afta pipo don go finish she go stil dey dia dey fool hersef for stage.
Chai! I no say Princess don dey prepia wetin she go replai Lolo.
Make I sidon for fence dey watch.

I GET QUERY FROM MY PASTOR AFTA I KISS FLAVOUR - CHIDINMA


Miss kedike,Chidinma don yarn say she get queri from her pastor afta she and Flavour Nabania dey kiss anyhow for di vidio of di song wey two of dem do.
Inshot,many pipo carry tori say,e be like say two of dem dey do touchingbodi bicos of di way wey dem dey kiss like say dem don dey do am since.
Altho Chidinma nor tell us weda dem sospendam for church or not but she hersef nor know say Flavour na craze for all dose kain tins?
Flavour?
Na who nor know Flavour go allow een fine sista dey play around am.
Flavour nor dey use eye see babe wey get fine smile.
Ask Sandra Okagbue and Anna Banner.
Wetin end dia own na two pikin wey dis two gehs born for di highlife singa.
Chidinma,di ball dey yor court,na u know wetin u won do witam.

Thursday, 21 January 2016

EFCC CHAIRMO DON ENTA ONE JOIN BODI MEETING WIT BOOKURU OGA,WOLE SOYINKA ,TO GET ADVICE ON HOW TO FIGHT KOROPSHON

Oga bookuru,Profeso Wole Soyinka don resiv di EFCC chairman Ibrahim Magu today and dia diskorshon dey base on di way foward to take fight koropshon.
Although many pipo gree say nor be bad tin to fight koropshon but make dem try torchlight oda tins make pipo for see di benefits wey gofment sopose bring come.
Dis koropshon koropshon talk don tire pipo.
Make gofment sef do show demsef make pipo klap if na to klap.


FELA PIKIN DON YARN SAY HANDCUFF TOO SMALL,NEXT TIME CARRY METUH GO COURT WIT LEG CHAIN

Fela pikin,Seun stil kontiniu di yabis for wia een papa stop as he don yarn one strong one konsigning Olisa Metuh,di forma talku talku pesin to PDP.
Metuh don enta Federa Govment wahala as dem trace N400million from di $2.1billipn of di wipons money wey Sambo Dasuki share among dem dem.


As I dey yarn wit u,Olisa Metuh dey jail and na from dia dem dey carry am go court.
Many PDP pipo don dey para for govment say why dem dey handcuff am come court evritime.
Now one pesin don vex as he say handcuff too small make dem carry Metuh go court next time wit leg chain.
Seun Kuti naim yarnam and he say why naija pipo go take di mata like one big ting.
Seun say dis na di same naija wey dem dey burn pipo witout trial sake of say dem call dem winsh.
Dem dey even burn crimina bicos of N20 and nobodi dey yarn and now dem handcuff pesin wey dem say he cramp N400million and e kon be one big news as pipo just dey talk nonsense.
Seun Kuti say next time wey dem dey carry am go court,make dem chain Metuh leg join.


PROPA CHILD ABUSE AS 28 YEARS OLD MAN DON MARRY 8 YEARS OLD GIRL FOR RIGASA,KADUNA

Dis one pass child abuse,dis one pass abomination,dis one na madness.
How any famili go giv away dia 8 year old pikin for mariage?
Na religion abi na famili choice?
Or na force dem use take make dis robish appun?
Woteva di rizin be,e show say devil and dis pipo dey eat spiritual moin moin togeda.
Dis one appun for Rigasa,Kaduna as 28 years old Baba Ahmed pay di bride price of di smallie on Sunday January 17 and akordin to di tori,he nor go sleep wit di girl till she rish 18 years.
See as dem even rob pancake full di smallie face like say dia head koret.
Wondas shal neva end.

Wednesday, 20 January 2016

ICE PRINCE SHUT UP! NA AKIN BUY YOUR GIRLFRIEND HER FIRST CAR AKORDIN TO LILYSANGEL1




Omo see gobe!
Wen we fil say we don hia di last tin konsigning Ice Prince,him and he geh frend,Maima and di married man Akin, di mata don take anoda twist.
Akin leak sonkain sikrit of how he take frend Maima some days ago but Ice Prince defend di babe say she dey inosent for di mata.
Bob, make I yarn u di Koko.
E be like say nobodi fit guess how e go end as one babe wey her name na Lilysangel1 for twita,don give Ice Prince kila punch say make di bobo kpror for were een kack.
Lilyangel say Akin naim veri gud frend and naim buy Maima her first car and if Maima tell Ice Prince wetin dey,dawon nor go make dia frendship crash.
See all wetin she yarn for bottom hia:





LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...