Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Wednesday, 15 October 2014
THE LORD IS GOOD! MERCY JOHNSON DON DELIVER BABY BOY
E be like say na America be di new place wey dey reign to go born pikin nowadays for naija celebrities.
Ty Bello deliver twin bois for America on monday, Flavor N'abania model babe, Sandra Okagbue, also born geh pikin last month Septemba 28 For America too.
Now na di turn of nollywood actress, Mercy Johnson as she don deliver a bouncing baby boi too for America.
She born di pikin at exactly 12:49am.
She marry Edo born prince, Odianosen Okogie and dem don born one 21 months old dota togeda wey her name na Purity.
WIZKID NA BAD PESIN-SAMKLEF
![]() |
| SAMKLEF and WIZZY in di bigining |
Dis na one yarnings wey u go always hear for pipo mouth concerning pipo wey dey bitray dia frends wen dem don hammer.
Big name producer, Samklef wey dey among di fest set of producers wey make Wizkid blow,don dey yarn dis kain words about di Holla at your boi singa.
Samklef wey produce about six jams for Wizkid fest album, wit tracks like don't dull and tease me, don yarn say, im be like Wizkid bifor but now he hate even im shadow.But sha o, im say im like Wizkid miuzik and na dia e end bicos di bobo don change and he head don dey swell since he stat to hama.
He say him neva spoil Wizzy name for any wia bifor for good 4 years but Wizzy tell one radio presenter say di rizin why he no dey work witam again na bicos im na schoolboy producer.
![]() |
| WIZKID and AKON |
Na on top twitter he for yarn all dis one and he also say,anytime wey im ask Wizkid, which levels? na so so post he dey postam for good four years.
He say na 250K dem pay am for six tracks wey im arrange for Wizzy and im try to take dat kain small moni for di kain koret beats wey im givam.
Wizkid imsef no waste time to reply all di wicked wicked tins wey Samklef yarn about am and say im dey sorprise say Samklef wey come visitam two weeks ago naim kon dey yarn all dis one?
He say im love Samklef like im blood and im dey pray make God kontiniu to bless im and im family.
.
Tuesday, 14 October 2014
CRISTIANO RONALDO DON GET 100 MILLION LIKES FOR FACEBOOK
Di likeness wey pipo don show say dem like Ronaldo for facebook don pass be careful as di World footballer of di year just reach 100 million likes on di 14 of October,2014.
Cristiano Ronaldo naim announce am for im facebook account imsef.
![]() |
| RONALDO AND FRIENDS |
Ronaldo dey beta form as he don alreadi score 17 goals for 9 matches dis season and many football fans don dey tipam to defend him world footballer of di year title if he kontiniu dis fine form.
STEPHEN KESHI DON CHALLENGE NFF TO SACK AM
Super Eagles coach,Stephen Keshi, dey para siriosly as he don challenge NFF to sack am if dem like.
He say if dem sackam today today,im go get anoda job one time bicos im na profeshona coach.
He say some pipo dey gang up against am make im for fail.
He say he no go mention dia names but dem know dia sef.
He say na big shame say some pipo no want make naija qualifai for di Africa nations cup but make dem know say dem no be God.
Di forma Strasbourg of France player,Stephen Keshi also yarn say, some pipo ready to sell naija for 2 kobo.
He say Super Eagles na naija own,no be Keshi getam,so if dem like make dem sackam anoda job dey wait am for anoda area.
One Nigeria football federation memba from di south south wey we follow yarn but he say make we no mention him name,yarn us say,sun tin dey worry Keshi for head bicos he no know wetin im dey talk.
He say dem dey givam plenti moni and free hand to do anytin wey him like wit di team but he dey find pipo wey im go drag dia name join im failure.
Super Eagles go play di return leg wit Sudan tomorow for di nations cup qualifai for Abuja afta dem lost di fest leg,one zero to di same Sudan for Khartoum on Saturday.
Monday, 13 October 2014
BIG BROTHER AFRICA FIRST HUSBAND AND WIFE, KEVIN AND LIZZY WELCOMES 2ND PIKIN
![]() |
| Di NEW PIKIN |
JOURNALIST AND FANS SAY KESHI MUST GO
![]() |
| AMAJU PINNICK Di NEW NFF CHAIRMAN |
But di big boss as dem dey call Keshi stil kack for chair as Eagles coach even tho rumors come say dem don sack am.
Di guild of sports editors for naija don come out now say di new NFF wey Amaju Pinnick dey lead must sack am bifor di return leg match for Abuja on wednesday.
Akordin to di yarnings wey dem bring out,di presido of di association, Mr Tony Ubani,say make NFF no allow Keshi yansh smell dat bench for di day of di match bicos he fall ova 100 million pipo hand for di match.
![]() |
| KESHI |
Dis jounalist association kon advice NFF say make dem no follow Keshi talk "con" not to talk of "tract" as he cup don full dey troway and he no deserve new contract.
Even kpakpa sef many football fans no won hear Keshi name for dia ear.
Out of 11 pipo wey I follow yarn Keshi mata afta di match,9 say make dem sack am bicos he don run out of ideas.
Super Eagles naim dey carry last for di group wit 3 matches to go.
South Africa get 7 points, Congo get 6 points, Sudan get 3 points and Nigeria get just 1 point.
TY BELLO DON DELIVER TWO BOUNCING BABY BOYS
Afta 9 years of marriage, baba God don bless di marriage of Naija artiste,Ty Bello and Kashetu Bello wit twin bois.
She born dis 2 bouncing bobos for America on Saturday and dem don alreadi giv dem name.
One name na Christian and di oda one name na Christopher.
Ty Bello just reliz her third album wey she call "Morning song book"some few days ago bifor she born di twins.
Di miuzik wey she take announce her name for di industry na The land is green .
Ty "Toyin" Bello stat miuzik wit di group KUSH bifor evribodi kon waka go cane dia line.
Oda pipo wey dey dis band dat year na, Lara George,Emem Ema and Dapo Torimiro.
Na she also be di official photographer to President Ebele Goodluck Azikiwe Jonathan and also di official photographer for Thisday Lifestyle magazine .
Congratulations to Ty and her husband Kashetu.
Subscribe to:
Posts (Atom)


.jpg)











