MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday, 16 November 2015

CHOi!SEE AS FEMALE FAN WON TEAR WIZKID TROUSER FOR MALI CONCERT

Dis tin nor be di way wey u dey see bifor again o.
Di way wey dis Wizkid mata dey go now,e don dey pass be kiafu.
Almost evriwia for Africa don dey catch di Wizkid fever as many fans both bois and gehs dey aprishiate tam.
Dis one nor be weda na inglish or French dem dey speak for dis kontris.
Di tin be say dem don alreadi love di bobo miuzik.
Di last time na Ivory Coast pipo showam plenti love.
Now na Mali dem for showam love as one babe escape enta stage go grab Wizkid for leg on top stage.
Di stadium sef full finish and enjoy demsef.
How di mata won be pass again?
Min why,Wizkid don give him fans anoda latest jam wey him call Final( Baba Nla)
You fit listin and enjoy di song for hia .......http://www.360nobs.com/2015/11/music-wizkid-final-baba-nla/

SHUO!NA BAD TING IF SOUND SULTAN WEAR ONE BOXER FOR TWO MONTHS?

SOUND SULTAN POSE FOR SEYI SHAY GROOVE
SOUND SULTAN FOR STAGE FOR 2BABA GROOVE
I nor know why some pipo no sabi mind dia bizness,shuo!
U know di latest tori for town now?
Dem say e be like say Naija ninja,Sound Sultan don sell him oda suits take buy one wine black jacket and na dis jacket he dey wear go all okayshon.
Amebor pipo say he wear dis wine jacket go 2face 40years old betday konsat for Eko Hotel on septemba 20,2015.
Two days ago,for di same Eko Hotel,he wia di same wine jacket go follow Seyi Shay jolificate for her album launch.

Di only diferense be say,he nod bow tie for Seyi Shay groove tinking say pipo no go know but dis yeye pipo stil know.
I nor undastand naija pipo at all.
Nor be wetin pesin get he go wear?
Sound Sultan nor mind dem jare dem no get work.
But sha,u sef Sound Sultan,u soppose try pass like dat.
As a celibriti or anybodi wey be star,di pesin soppose get plenti jacket for differen okayshon so dat amebo pipo nor go carry yor mata for head.

Abeg, make yor check hia for di next tori......http://ogakpatakpata.blogspot.com.ng/

Sunday, 15 November 2015

I NOR QUICK KNOW SAY,SAGGING NO SOPPOSE DEY MY DICTIONARY-NAETO C

"God I tank u oooo......I nor know why e take me long time to know say sagging na bastard."
Dis na all wetin come out from Naija miuzishan,Naeto C mouth.
E remain Davido and di rest of dem wey carry sagging for head like lakpalakpa to know say sagging no dey reign again.
Naeto C yarn say him dey sag welwell bifor but as he dey grow,he kon find out say na yeye tin to dey sag.
Di 10 ova 10 singa say,wen he small,he no care about di kain eye wey pipo take dey lookam but now evritin don change.
Di bobo na sagging born again.
Now he fit pour u hot water even tho u won giam one million just to sag.
Naeto C say him costoma na mature sombodi wey like to dey giam bizness and na dis kain pipo him dey paform for.
He also say,if u kontiniu to dey sag and u go meet dis same pipo for bizness,dem fit look u wit small pikin eye but now him don mature and sagging don comot from him dikshonari.

ABEG YOU KNOW ANY NAIJA CELIBRITI WEY FINE PASS DIS WOMAN WEY I SIGHT FOR GENEVIEVE GROOVE?

Sombodi gasto to tell me wetin I neva hia bifor concerning dis woman wey her name na Omotola.
Big name for nollywood and home vidio mata,Omotola and her biuti, fit stop rain to fall for some kain area.
Di babe biutifu finish no be small.
How pesin go still dey fine wit age afta four shidrens?
Omotola don turn wine wey be say,as di year dey fly,e go dey strong more more?
Shuo!
Make I no talk too much,check out her foto wen dem snapam as she play enta veniu of di launching of Genevieve Nnaji film"Road to Yestaday" wey appun for Lagos.
See more hia I nor fit shout!


Saturday, 14 November 2015

OMO,SEE HISTORY AS R.KELLY DON FEATURE WIZKID FOR HIM NEW ALBUM,"BUFFET"

Like play,like play dis one don pass moin moin talk o.
Wizkid of today nor be di smallie of yestaday again as di boy levels and GP dey rise like tempraychor for inside car wey hin coolant don finish.
Since obodo oyibo rappa,Drake remix Ojuelegba wit Tinnie Tempah,na up above di sky tins just dey appun for Wizzy side.
Many intanashona miuzishan just dey praise di bobo and him track,Ojuelegba.
Alicia Keys and her hosband,Swizzbeatz join dia mouth for di praise too.
As if dat one na just di bigining of God favour for Wizkid life be dat,di biggest grace don fall on topam as R.Kelly don fichoram for him new album wey dem call "buffet".
Dis kain tin neva appun for any home base Naija artiste bifor say Grammy award winna and grade A miuzishan from obodo oyibo fichor u for him song.
Di one wey evribodi know na di Naija miuzishan go pay beta moni just to put di voice of dis pipo for dia song.
Abi u don forget R Kelly now now?
In case u don forget,R Kelly na one miuzishan wey di hole world dey die for him miuzik.
From cape to Cairo,from lokoja to Italy,from yaounde to livapool,from ethiopia to Canada,dem dey respect R Kelly to pieces.
Di guy don put Wizzy for di jam wey him call,"I just want to thank you" and if i hia say na babe dem dey thank instead of baba God for di song,I go para for R.kelly like say he dey owe me 50billion dollars.
Oda miuzishans wey dey dis album na Ty dollar $ign,jhene Aiko,Juicy J,Jeremih,Lil Wayne and Tinashe.
Omo wen God put hand for yor mata,e nor pass like dis.
I pray make God notice yor mata dis morning bifor di next tori.

Friday, 13 November 2015

AFTA 30 DAYS FOR ATLANTA,AY DON READY TO RELIZ ANODA NEW HOME VIDIO "A TRIP TO JAMAICA"

For dose of una wey dey hapi as nollywood dey grow,God don bota una bread again wit anoda wicked home vidio "A trip to Jamaica".
Ayo Makun,if u like call am AY di comedian,wahala nor dey.
Afta di bobo enta di industri wit "30 days for Atlanta" di film wey win ogbonge awards for home and abroad,AY don readi to reliz anoda one..'A trip to Jamaica'.
Nor be Jamaica?dem nor dey use dia leaf chocolate take play for yonda.
We go see Akpos for Jamaica,but weda he taste dia chocolate or he hide Kwale chocolate from hia go yonda,we go know.
Apart from Bob Marley,di life of many pipo wey taste Kwale chocolate nor dey remain di same afta dem taste tam.
AY borrow some Hollywood actors like Eric Roberts,Dan Davies take act for di film.
Also,anoda big name wey show face for dis home vidio na Paul Campbell aka Capone,dat baddest nigga wey act for third world cop,di ogbonge Jamaica film.
Oda pipo wey show dia jersey nomba for dis film na Chris Attoh of Ghana,Naija representas Nse Ikpe Etim,Raskimono,Pato Ranking,Cynthia Morgan,AY(akpos) and him babe,Funke Akindele wey her name na Bola for di film.
Pipo don alreadi dey hurry to watch dis film as e dey hot,di only tin wey dem dey wait,na wen e go enta cinema and market.
Check out more foto for bottom hia:


Thursday, 12 November 2015

JAH RASTAFARAi!I NOR FIT SHOUT,I NEED MY DADA BACK-TIMAYA

If we say make we use di latest foto wey Timaya snap take yarn,naim be say TimaYa bodi language don dey tell us say he nid him dada back badli.
Di egberipapa one of Bayelsa put dis foto for instagram to take show pipo him new hairstyle.
Anoda set of dada don dey jaminate for Timaya head.
Wen he barb di fest dada wey we take knowam,some pipo say he don barb di robish troway.

Shuo!naijaa pipo una too get mouth!
Anyway,make we see how dis new dada go be for him head.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...