MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday, 4 November 2014

BREAKING NEWS! BOKO HARAM TAKE OVER ASHAKA CEMENT FACTORY


Like play like play, di terror group, Boko Haram don dey capture some towns and villages for north.
Di tori wey dey reach our table now now now be say, dem don take ova Ashaka cement factory for Gombe state.
Days afta Dangote cement and some oda cement compinis reduce bag of cement to one thousand naira,Boko Haram wit dis attack,don make statement for di industry.
If u check and balance am, dis one fit carry cement price back to 2K plus again bicos e go surely affect production.

Afta Boko kill 5 pipo including one Sheikh ( leader), naim dem buss enta di cement factory for Gombe state and soranda di whole  compound.
Akordin to workers for Ashaka cement factory, di Boko Haram rambos enta dia yard wit heavy heavy weapons and dem begin shoot anyhow and shoot anytin at sight including di workers afta di main guard dem run for dia dear lives.
As at di time wey we take write dis tori, we neva get any report say anybodi die for di take ova attack.

I WILL DEFEAT GOODLUCK JONATHAN WITHOUT SWEAT-ROCHAS OKOROCHA



Di Govnor of Imo state, Mr Rochas Okorocha don say make anybodi no doubt am bicos im go defeat President Ebele Jonathan for di 2015 presidential election hands down if dem givam chance.
He yarn dis one for di rally wey one group for north, Arewa Pipos Grand Coalition organize foram for Kaduna to convince am to contest di 2015 presidential election.
He say among evribodi like Atiku Abubakar, Buhari, Kwankwanso wey won contest unda All Progressives Congress,APC, nobodi wey dat Aso Rock chair go fit reach am.
 Okorocha say among all of dem wey dey say dem won be President, none of dem done provide free education for any state or any part of di kontri bifor.He say na only him done provide free education for im state and for some part of di kontri.
He say if naija pipo make am presido, naim be say pipo go enjoy free education and free evri,o.va and ova again.
Bifor di join bodi rally, Okorocha don carry waka go meet di Emir of Zazzau, Alhaji Shehu Idris and lay di foundation of Rochas Secondary school for di area and he say wen di skul stat, na free e go be.
Govnor Okorocha wey sabi speak Hausa language veri well no dissapoint di crowd bicos na di language and English he take break all di yarnings down.
Di govnor say di only problem wey APC get na to pick di pesin wey go veri hard and difficult for PDP to defeat.
He say, make dem pickam bicos naim be di only pesin wey go bring victory to APC and him go  win Jona without any sweat.

Monday, 3 November 2014

NIGERIAN FOLORUNSHO ALAKIJA,9TH RICHEST WOMAN IN THE WORLD


Nigeria bizness woman and billionaire, Folorunsho Alakija name don appear as di numba 9 richest woman for di whole world.
Akordin to di America website, Wealth-X, Folorunsho Alakija wey dey into oil, printing, fashion and oda biznessis, worth 1.2 billion dollars.
Di rumors wey we dey gada now be say, na she be popular Dj exclusive mama even though we still dey wait for confamation.
Wealth-X say dem arrive wit dis list base on di selection of di richest woman for each areas for di world.
For Africa area, na Folorunsho Alakija dust all di rest women including one time richest woman for Africa Isabel Dos Santos from Angola.
To know di top 9richest women for di world, make u check bottom hia:

1.$37.9b Christy Walton North America
2. $31.3b Liliane Bettencourt Europe
3. $14.8b Gina Reinhart Pacific
4. $6.3b Vanessa Paola Slim Latin America
5. $6.3b Soumaya Slem de Romero Latin America
6. $6.3b Johanna Monique Slim Ayub Latin America
7. $.3b Uang Huiyan Asia
8 $4.2b Shari Arison Middle East
9. $1.2b Folorunsho Alakija Africa

Sunday, 2 November 2014

BOB MANUEL UDOKWU AND TONY ONE WEEK IN A FIGHT FOR ANAMBRA STATE HOUSE OF ASSEMBLY SEAT


Dem say if two elephants fight, na di grass dey sufferam.
Nollywood friends don enta agreement to test dia popularity for Anambra state house of assembly for di 2015 general elections.

MAMA REJECT N400,000 NAIRA TO GIVE HER PRIMARY 6 DAUGHTER OUT FOR MARRIAGE

BABIRYE KASUUBO
A 37 year old woman, Babirye Kasuubo from eastern Uganda na di talk of di town afta she reject sh602,000 Uganda shillings about 400,000 Naira from one man wey won marry her daughter wey dey primary 6.
Infact village drunkards especially, don dey laugh her and call her"foolish woman" sake of say she reject di moni.
Kasuubo despite di fact say she poor finish, reject di raba bicos she want make her pikin go school and grow up to bicom responsible pesin.
Kasuubo wey come from Kiige village, Balawoli for Kamuli, don dey single since she separate from her husband, Richard Basoga 12 years ago and na corn and beans wey she dey grow for farm dey survive her.
Di mata appun wen di guy,25 years old John Odongo wey be fisherman, waylay her dota on her way back from skul and force envelope put for di pikin skul bag and tell her say, e contain "veri sweet message" for her mama.
As di geh rich house, she give her mama di envelope.di mama carry di envelope straight to her pikin headmaster, Mr Joab Kyalo of Kiige Primary school and dem see 400K for inside wen dem open am.
John Odongo sign for di letter sef and na im friend,Julius Opolot hepam write di letter.
Odongo papa also sign for di letter as witness.
For Kisoga culture, anybodi wey won be son-in law, go write letter inside envelop and put moni starting from sh200,000 and above.
Once dem accept wetin dey di envelop,dem go kon arrangement for di traditional marriage.
But for Odongo case, sh 600,000(N380,000) na for di geh papa and mama, why sh2,000 na for pesin wey read di letter to dem.
Di HEADMASTER,JOAB KYALO
Di headmaster wey know say na di geh life dis boy won destroy for ground no waste time as he report di mata to Balawoli police station so dat dem go deal wit Odongo.
As we dey talk so, Odongo don take yawa race comot for bunk as he hia say police dey find am.but im papa, Vono and friend Opolot na dem kon use head carry am as police don arrest dem and detain dem for Kamuli Central police station.
Di headmaster explain say as di Head of di school, im duty na to make sure say di shidren finish and complete dia primary 7 bicos of late so so belle naim di gehs dem dey carry.
KIIGE PRIMARY SCHOOL
He say for 2012, im stop one traditional marriage ceremony for one primary 7 geh wey dem come pick from classroom to go marry.
He also yarn say for di same year, 3 gehs marry why 2 odas write dia Primary Leaving Examination ( PLE) wit pregnancy.
For 2013, he say na 7 girls get belle.
Di headmaster, Kyalo say dis year,2 girls for primary 6 don get alreadi belle and he say e dey veri embarrassing bicos dem celebrate "Di International Day of Di Girl Pikin" for Kamuli just last week.
Meanwhy, di mata of di geh won dem won marry don tie new wrapper bicos since police reliz Vono and Opolot on bail, dem don twist di mata and open dia own fresh case say, di geh mama, Kasuubo, na tiff she tiff dia money no be for any marriage.
We go dey wait to hear how di mata go end.

Saturday, 1 November 2014

BOKO HARAM SAY DEM HATE NEGOTIATIONS, MAKE DI WORLD EXPECT MORE KILLINGS



Boko Haram ogakpatakpata, Abubakar Shekau wey di millitary claim say don die,don reliz anoda video yestaday wia im for yarn im mind.
Na hausa language di guy take yarn evri.

RICHARD LAWSON,THE BOYFRIEND TO BEYONCE MAMA, TINA KNOWLES, DON ENGAGE HER


Dog meat is a noun, siddon look is a verb.
Ewooo! NA wetin pesin no go hear for life.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...