MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 9 June 2016

AMERICA SUPASTAR TURN WIZKID TO WIZARD


Chris Brown and Wizkid frendship just dey dey strong evri singo day wey pass.
Di forma Rihanna boyfrend carry Wizkid follow bodi dey play show round Europe right now.
Dem start wit di show for Denmark and yestaday dem plasta mata for Hamburg,Germany togeda.
Dat na wetin I dey call,strong love for di naija Starboy be dat.
As if dat one na di biginning,Chris Brown don post drawing and karikachor of Wizkid on top een Instagram page and write for botom say make dem "konfiuz di wizard".
Dem pack chukuchuku for Wizzy bodi for di artwork to take konfiuz di wizard like say tomorow nor dey.
Who don arrive don arrive.
Dis Wizkid arrivement nor be hia o.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...