MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 8 June 2016

SUPASTAR SINGA,WAJE SAY,SHE NOR GO DO DAT KAIN MISTAKE TO ALLOW HER DAUGHTA GET BELLE LIKE HER BIFOR MARRAGE


One of naija bigest singa,Waje,don yarn say,di mistake wey she make wen she dey yong,her pikin nor go do dat kain mistake.
Waje born her only dota wen she neva tear eye as one bad boy draw her enta ikoro giam belle.
U fit call dat one kelekele love akordin to Tiwa Savage.
She be 17 years old wen she carry belle.
Waje say she nor go allow any crazy boy draw her pikin go kona go giam belle di way wey dem do her.
She don buy cutlass dey wait dat Yeye boy wey won giv her ripe dota belle bifor marage.
Her dota Emerald,don dey play enta 18 years now and she look like all dose kain shidren wey dey big pass dia age.
Guys,una don hear o.
If nor be marage yarns,Waje say make una nor kom plock mango for her backyard bicos of her dota.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...