MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 5 June 2016

BRYMO DON ADVICE ONE BOBO FOR TWITA TO FORGET ABOUT SCHOOL JUST BICOS Di BOBO BEGAM N65K




Forma chokolate city top singa,Brymo,don advice one of een fan wey begam N65K for twita,to drop from school bicos na wetin him do be dat.
We gree say pipo don too dey beg selebriti money on top Facebook,twita and Instagram,but dat na Yeye reply.
If u liv school porshoe miuzik,naim be say evribodi must liv school too?
E beta make he nor reply or do like say he nor see di bobo mesage,dan make he dey yarn puan.
Di boy sef givam anoda beta reply as he tell Brymo say if he nor like school,school naim own dream as he dey hope to bikom di best computer engineer one day.
Brymo u be Yeyebiti of di week for dat yarns.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...