MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 4 June 2016

BREAKING NEWS! BUHARI DEY SICK AND HE DON DEY RECEIVE TRITMENT ON TOP HIM DEAF LEFT EAR


We don finalli know di reason why una president,Muhammadu Buhari nor dey travel travel for ova two weeks now.
Akordin to tori wey enta our garden,dem say di man dey sick and he nor too moch dey hia word again wit een left ear.
Also,akordin to our man wey stand gidigba around Aso Rock fence dey feed us wit tori,he say,merisin pipo don dey givam tritment for Aso Rock make he nor go deaf kpatakpata bicos di ear dey pain welwell.
He don kanso three waka for inside and outside naija for some time now and na Vice Presido,Yemi Osinbajo he dey send go reprezentam.
He sopose go launch di nyanma-nyanma wey dem don start to comot for Ogoni river for Rivers state.
Dis nyanma-nyanma for Ogoni land,nor make di pipo fit dey use di river take do any beta tin like fishing,as oil wey spill don put kemikal inside.
As u dey read dis tori like dis,Osinbajo don even enta road go reprezent Buhari for di nomba 48 odnari submit of head of state and gofment of di Economik Cominiti of West Africa State (ECOWAS) wey go appun for Senegal dis wikend.
Make we dey wait to hia weda di merisin go work for een ear or dem go fly yam go obodo oyibo for propa tritment.
Make dem try fly yam go yonda.
He most use di merisin wey giv our hospitas for hia.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...