MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 7 June 2016

OYIBO BABE FROM BRITAIN,BORN FOR 13 YEARS AND FOR 23 YEARS,SHE DON BORN 6 PIKIN ALREADY



Her name na Shannon Carter and for 23 years she don alreadi born half dozen.
Her boyfrend,Gavin,wey be 17 years dat time giam belle wen she be 13 and since dat time dem don add 5 join to make am six shidren.
She say nobodi kontrol her wen she young as her papa brake up wit her mama wen she be 7 years.
Her papa nor send her and bifor her mama die,she dey always shout foram.
Akordin to Shanon,she say she nor know say she get belle until Boxing Day (26 December).
She fil say na ova feeding dey worry her until she kon find out say na pikin dey grow inside her belle.
She yarn tori pipo,daily mirror say,wen she born di pikin da' year,doctors nor even advise am on how to take kia of pikin and she nor blame dem bicos dem nor rememba giv 13 years old girl wey turn by force mama advice.
Six shidren for 23 years much sha.
Make she take am izi.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...