MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 10 June 2016

WAIT O! PAUL OKOYE SIGN LUCY FOR RUDEBOY RECORD BICOS SHE REZEMBO RIHANNA OR BICOS SHE SABI SING?


Di nomba of times wey Rudeboy record artist Lucy don show us her breast and some oda flesh for her bodi,don pass di nomba of times wey moskito don suck pipo blood dis year.
Di babe fine nor be small and she kon rezembo my babe Rihanna from head to her toe.
Di only tin wey make pipo dey vex foram now be say,dem neva hia any miuzik from her wey fit make Tiwa Savage and Yemi Alade sorenda dia keke seat.
Di only song wey Paul Okoye PSquare,di owna of Rudeboy records don reliz foram stil dey strogle for di industri like westbrom.
Her naked pishors full evriwia pass her miuzik.
Wich levels Paul?


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...