MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 6 June 2016

ATIKU ABUBAKAR SAY MAKE YOU BLAME OBASANJO FOR Di LIGHT PLOBLEM WEY WE DEY SUFFER TILL TODAY


Forma Vice President Atiku Abubakar,don yarn tori pipo say make we blame een forma oga Olusegun Obasanjo for di light wey neva stil steadi for dis kontri.
I don dey mad o.
Steadi?
Make I start again.
Forma vice presido,Atiku Abubakar,don akiuz Obasanjo as di pesin wey make us nor dey get light for naija.
He say dat time wey dem dey pawa,him advice Obasanjo say,make dem biud plant wey nor go dey use gas to take supply light,but Obj say no.
He say een reason be say until dem solv Niger-Delta ploblems,to dey get gas nor go izi since oil gbege always dey dey dat part of di kontri.
Today dem buss pipeline,tomorow dem bomb oil well.
Atiku say een notice all dis tins bifor him giv di advice but di Ogakpatakpata of Nigeria dat time,Obasanjo nor listin toram.
So diafor,Atiku say if u dey look for who to blame for di NEPA wahala,nor look far just blame Obasanjo.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...