MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 3 June 2016

LIKE PLAY,LIKE PLAY,LIONEL MESSI GO STAY PRISON FOR 2 YEARS IF COURT FIND AM GUILTY OF DODGING TAX PAYMENT

Messi and hin papa for court
Reigning world futbola of di year and baddest Barcelona playa,Lionel Messi go soon enta prison if court nor gbadu een argument of why he nor dey pay tax since.
You know say court wahala nor dey rish pesin for bodi.
If dem yarn dem don yarn.
Akordin to di tori wey dey enta our backyard,Messi and een papa dey face court queshons rite now for di city of Barcelona.
Na Messi papa,and some oda konpinis dey hando Messi bizness but e be like say dem nor dey pay tax since and all ova di world,dat na heavi ploblem.
Messi don tell court say,di time wey him dey sign di papers,een nor dey read wetin dem write for di papers bicos he biliv say hin papa and di konpini go always hando di mata well.
Di Argentina playa say na futbol him dey play,
If court nor see any sense for Messi argument,he go enta prison for like 2 years and dat one go be big blow for een clob and big blow for futbol fans wey dey enjoy di bobo skills.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...