MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 9 June 2016

NIGERIA RADIO OWNA,CHRIS UBOSI,DON CARRY RIHANNA AND JAY Z GO COURT BICOS DEM FAIL TO COME SING FOR NAIJA AFTA HE PAY DEM


Three years afta Beat fm,Lagos owna,Chris Ubosi pay Rihanna and her oga,Jay Z money to come paform for naija witout dem nor show face,he don finali carry dem go court for America.
Di show 'megalectrics' sopose appun for May 2013 for Eko Hotel but Rihanna nor come.
Akordin to Ubosi,he pay $160,000 dollars wey be ova 30 million naija money but dem begam make dem carry di show go July.
Chris Ubosi
Since dat time come rish now,Chris Ubosi say him nor see Rihanna,he nor see money and na dis one naim make am drag dem go court.
Rihanna camp don come out to deny say,dem nor resiv any money.
Dem say maybe na 419 don bobo our man.
Dis one strong o.
Make we dey wait for di court to start dia investigation bicos dat money plenti nor be small.
As una dey wait to hia more tori for di mata,read more of our tori make di world nor go take off liv you.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...