MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 7 June 2016

BREAKING NEWS! STEPHEN KESHI,Di FORMA TOGO AND NIGERIA COACH,DON DIE


Ah!
I nor expect dis news at all,at all!
Nigerians and di rest of di world wake up come hia say,forma Super Eagles captain and Coach,Stephen Okechukwu Keshi,don kpai.
Akordin to di tori,dem say na heart attack naim killam for Benin City early dis morning.
Keshi naim be di first Nigeria coach wey win di Africa cup of nations for us for 2013 and he also qualify naija for di 2014 World Cup.
Apart from Nigeria wey him coach,he also coach Mali and qualify Togo for di 2006 World Cup for Germany.
He play for many clubs around Europe and Africa including Strasbourg for France and Anderlecht of Belgium.
He even captain Anderlecht wen he play for dem.
Keshi lost hin wife last Disemba afta she battle cancer for three years and now cardiac arrest don take di big one.
Rest in Peace di 'Big Boss'.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...