MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 2 June 2016

MINISTA OF TALKU-TALKU,LAI MOHAMMED SAY NA BOKO HARAM MAKE TOMATOES DEY SCARCE


Anoda round of tori don fall out from di mouth of Lai Mohammed,di minista of talku-talku wey u also fit call minista of information.
Buhari right hand man don yarn say na Boko Haram make tomatoes scarce and dey xpensiv.
Even if u dey obodo oyibo,u go don hia say tomatoes don turn to gold as 4 sid of tomatoes dey sell for N500 nawadays.
Tori wey we bin dey hia since be say, na tomatoes Ebola,one bad diziz wey enta tomatoes farm for north,naim make tomatoes nor dey.
I nor kon undastand di one wey Lai Mohammed kon dey yarn now.
Dem Dem say na Ebola tomatoes naim cause di skasiti,di same Dem Dem don say na Boko Haram korsam.
Akordin to Lai Mohammed,he say for ova three years Boko Haram wahala don skata di northern area and dia is no way wey be say pesin fit do farming for wia war dey.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...